Arsenal vs Leicester City highlights: Gunners win 2-0 as Alexandre Lacazette and Thomas Partey score for Emirates

Thomas Partey score for Arsenal

Getty Images

Arsenal return to occupying fourth position for di Premier League afta dem beat Leicester City for Emirates stadium.

Dem beat di Foxes 2-0. Thomas Partey and Alexandre Lacazette score.

Di Gunners bin dey fifth position, two points behind Manchester United wey defeat Tottenham 3-2 on Saturday.

Cristiano Ronaldo score hat-trick to help di Red Devils overcome di determined Tottenham for Old Trafford.

Arsenal bin dey hope to win and collect three points to be able to climb to di fourth position ahead of Manchester United and dem do am.

As e be so, Arsenal don win nine of dia past 10 games for Premier League.

How di match dey happun live

FIRST HALF

Before di game start proper, both teams line up on di pitch behind banner wey dey in Ukraine flag colours with di message “Football Stands Together”. Everyone for di stands dey on dia feet dey clap.

KICK-OFF

1 min: Arsenal 0-0 Leicester

We don start for Emirates.

3 mins: Alexandre Lacazette win di battle wit Daniel Amartey to get di ball inside Leicester area. Lacazette find Bukayo Saka but e no fit get di shot away.

5 mins: Five minutes in and no chance yet but Arsenal don dominate di possession so far.

8 mins: Gabriel Martinelli chase di ball down go di left and try to go past Ricardo Pereira inside di box. Martinelli go down as e challenge Pereira and some pipo dey shout penalty but e bin go down easily and di referee no dey interested.

10 mins: Kasper Schmeichel do well to keep out a point-blank shot from Gabriel Martinelli. Di flag go up for offside but regardless dat na fine block by di Leicester goalkeeper.

11 mins: GOAL!

Arsenal don get di better of di opening exchanges. Dem don get 62% possession so far as dem score first corner of di game. Na Thomas Partey head am in from corner.

15 mins: Arsenal keep up di pressure as dem dey look to add a second goal. Dem win di ball high up but Granit Xhaka play one forward ball to nobody ane e go for goal kick.

17 mins: Notin much yet from Leicester in terms of attacks, not even one. Na defending levels dem dey for now.

19 mins: Arsenal go forward and play nicely to get into di box. Dem dey patient, dem dey try to find di right moment to shoot. Granit Xhaka shot dey blocked before Partey curl one ogbonge ball against di angle of di post and di bar.

21 mins: PENALTY APPEAL

Bukayo Saka drive enta di box and go down with Leicester legs around am. Arsenal fans wan penalty, dem no give dem.

24 mins: Harvey Barnes dey picked out by one brilliant ball over di top by Kiernan Dewsbury-Hall. Di angle tight for Barnes and im shot dey deflected go corner, Aaron Ramsdale come punch am comot.

Arsenal vs Leicester

Getty Images

26 mins: Aaron Ramsdale push one low cross from di left into di middle of di box and James Maddison try to open up a bit of space for imself to shoot but Ben White challenge am well.

28 mins: Some nice passes from Kieran Tierney and Martin Odegaard as Arsenal bring di ball forward and work am give Bukayo Saka, wey go on to shoot but e dey blocked.

30 mins: Alexandre Lacazette get chance for Arsenal. E shot poweful shot but e go straight to Kasper Schmeichel.

32 mins: Gabriel dey down. Na afta e and Kelechi Iheanacho get small accident, Iheanacho put im hand for Gabriel face and e result to yellow card for am.

38 mins: Tins don change now. Arsenal now dey try to collect di ball from Leicester.

40 mins: Cedric no wan take any chance as e go behind James Maddison excellent ball inside di box.

43 mins: Alexandre Lacazette clip Marc Albrighton as di Leicester midfielder break forward. Leicester get a free kick midway inside di Arsenal half and James Maddison send am into di area for Caglar Soyuncum wey shin am over.

45 mins: HALF TIME!

Referee don blow and na Arsenal dey lead, but Leicester finish first half strong.

SECOND HALF

KICK OFF

46 mins: No change for either side as second half resume.

51 mins: Gabriel Martinelli manage to keep di ball in play afta e skip Ricardo Pereira shot. E cut am back to Alexandre Lacazette, wey im shot deybblocked before Kasper Schmeichel punch away Bukayo Saka hooked effort.

54 mins: Gabriel Martinelli win foul afta e dey being pulled back wen e try to get through two Leicester players. Arsenal get free kick on di left.

56 mins: Somehow Leicester keep di ball out of dia net as Martin Odegaard free kick find di box and Kasper Schmeichel do well to keep out a shot from point blank range before Thomas Partey header dey cleared off di line.

57 mins: VAR dey check if Caglar Soyuncu use hand for di ball from Thomas Partey header and e be like say e do am.

58 mins: Anthony Taylor award penalty to Arsenal. Caglar Soyuncu collect booking afta di ball touch im fingers wen Thomas Partey try to head am in.

59 mins: GOAL!

Alexandre Lacazette score di penalty.

Arsenal players celebrate but Leicester players are fuming.

60 mins: Kasper Schmeichel dey question Anthony Taylor but di goal go stand.

62 mins: SUBSTITUTION

Leicester boss Brendan Rodgers respond to dat goal by sending on James Justin and Wilfred Ndidi for Ricardo Pereira and Nampalys Mendy.

65 mins: Leicester break quickly as dem dey look to get a goal back and Marc Albrighton shoot from outside di box but e hit two Arsenal players to take di power comot am and Aaron Ramsdale stop am easily.

67 mins: Kieran Tierney hammer di ball away out of di goal way as Harvey Barnes bin wan hammer am in from close range.

70 mins: Twenty minutes to go and e be like say Arsenal dey cruise to a fifth consecutive win.

72 mins: Kelechi Iheanacho play one shot towards goal from just outside di box but Aaron Ramsdale catch am.

74 mins: Kelechi Iheanacho dey replaced by Patson Daka.

76 mins: Emile Smith Rowe dey on for Arsenal for di closing stages and dem clap for Gabriel Martinelli for an impressive performance as e go off.

78 mins: Granit Xhaka go through di middle. E get plenti support but im shot go over.

80 mins: Patson Daka bring down Bukayo Saka as di Arsenal forward drive towards di area. Di Leicester substitute collect cars and di Gunners get free kick 30 yards from goal.

81 mins: Cedric float di ball in, Leicester head away but Bukayo Saka pick up di loose ball before e shoot am but im effort dey blocked.

Leciester and Arsenal players during di game

Reuters

83 mins: Kasper Schmeichel block Emile Smith Rowe shot from a tight angle.

85 mins: SUBSTITUTION

Bukayo Saka, dey limp small afta one heavy challenge, dem replace am wit Nicolas Pepe for di final few minutes.

87 mins: SUBSTITUTION

Another change for Arsenal. Eddie Nketiah dey on for Alexandre Lacazette.

88 mins: Patson Daka try to turn wit di ball inside di area but too many Arsenal players dey around am.

90 mins: We just dey wait for di final whistle now. E no be like say anytin else go happun.

FULL-TIME

Arsenal 2-0 Leicester

Arsenal don make dia fifth consecutive Premier League win.