Chelsea: Roman Abramovich say e plan to sell club and ‘donate proceeds to war victims’

Roman Abramovich

Getty Images

Chelsea owner Roman Abramovich tok say im dey plan to sell di Premier League club.

Di Russian billionaire for statement tok say e ”don take di decision to sell di club” and promise say e go ‘donate di proceeds to charitable foundation for di benefit of ”all victims of di war for Ukraine”

E say ”I believe say dis na in di interest of di club, im fans, di employees, as well as di club’s sponsors and partners.”

Abramovich wey don deny say e get financial link to Russian President Vladimir Putin or di Kremlin but don come under increasing scrutiny in recent days, tok say di sale go dey fast-tracked.

Report bin earlier comot say one Swiss billionaire Hansjorg Wyss tell tori pipo, Blick say Roman Abramovich don offer am di chance to buy Chelsea football club.

E say di Russian billionaire “wan offload Chelsea sharp-sharp” afta dem threaten am with sanctions for Parliament.

Wyss bin also tok say, “I and three oda pipo bin get di offer to buy Chelsea. Abramovich dey try sell all im villas for England and also wan comot Chelsea from in hand sharp-sharp.”

Abramovich bin hand ova “stewardship and care” of di club give dia foundation trustees afta Russian invasion of Ukraine last month.

Wetin don happun for Chelsea since Abramovich buy am

Abramovich buy di club for 2003 for £140m, e don borrow di club pass £1.5bn wey don held di club wella.

Chelsea don win all di trophies wey dem fit win under di Russian reign.

Dem include:

  • two Champions League
  • Five Premier League
  • Five FA Cups
  • two Europa League
  • three League cups
  • di 2021 Uefa Super Cup
  • club World Cup

Week of wahala for Chelsea

24 February: Russia President Vladmir Putin bin launch military invasion enta Ukraine.

25 February: Labour Chris Bryant tell MPs say make di UK goment comot Chelsea from Roman Abramovich and seize im asset say im get hand for wuru-wuru.

26 February: Abramovich announce say e dey handover “stewardship and care” for Chelsea give dia charitable foundation.

27 February: Foundation members dey question weda dem fit run di cluub under Charity Commission rules. Che;sea beat Liverpool 11-10 on Penalities for League Club Finals.

28 February: Abramovich collect request from Ukraine to support dem to fit reach “peaceful resolution” with Russia.

1 March: Di Charity Commission say e dey “find information” from Chelsea afta dem give di club control for im charity foundation.

2 March: Swiss billionaire Hansjorg Wyss claim say dem give am offer make e buy Chelsea.

2 March: Abramovich announce say e dey sell club