Jaruma: Court order re-arrest of Hauwa Saidu say make dem remand her for Suleja prison

Di Upper Area Court, Zuba for Abuja don revoke di bail wey dem grant popular aphrodisiac seller Hauwa Saidu wey pipo popularly sabi as Jaruma.

Presiding judge, Barrister Ismail Abdullahi Jibrin for im ruling say make police re-arrest Jaruma and remand her for di Suleja Correctional Centre, until March 17, 2022 di new adjourned date.

Di judge vex as Jaruma and her lawyer no show up for court and dem no send any representation.

Earlier for court, the judge stand down di case sake of say she and her lawyer no show up.

One oda lawyer, wey describe insef as friend of di court, beg court to give dem small time in a bid of fairness to all parties.

Di judge come give dem more than two hours to come or send representative before e rule, yet nobody show up afta di two hours grace period di judge give.

Prosecution Lawyer Inegbinoise Edwin appeal to di court to revoke her bail, since she jump bail and no show face for court.

Di judge para say na mockery to di court and Judiciary and if di defendant ignore court and e go bad if court no take action.

Therefore di court must take action.

“I hereby issue Bench warrant against one Hauwa Saidu Mohammed also known as Jaruma, I order di surety to show cause and explain to us why she no show face for court”

“Dis case dey adjourned to March 17, 2022”. Di judge tok.

Jaruma dey face two count charges of defamation of character and drug abuse.

Di mata so far

Police bin charge Jaruma to di FCT Upper Court wia dem remand am for Suleja prison.

Jaruma plead not guilty to di charges and im lawyer apply for bail wey di judge bin adjourn to Friday, 28, January, 2022 to hear di application.

Jaruma spend four days for Suleja prison.

Upper Area court for Zuba come grant Jaruma bail on 28, January 2022 afta dem bin remand her for prison.

Presiding Judge for di mata Barrister Ismail Abdullahi Jibril bin say di charge against Jaruma dey bailable but e no dey ordinary.

As part of her bail condition, dem ask aruma to present one surety wey dey on grade level 13 wey dey work for FCT, Abuja.

Di judge also warn all parties involved for di case say make dem no engage in any prejudicial act.

Di kayamata seller comot from di court room with celebration as her friends dey hail her as “di first female president” of di kontri.

As body dey sweet her, she reply dem say, “I go run for 2023 wey dey come so, e no go far again”.

Jaruma for court

BBC
Jaruma for court

Jaruma arrest and detention

Jaruma and Ned Nwoko family gbas gbos start wen she claim for Instagram post say she pay Ned Nwoko wife, Regina Daniels 10 million naira to advertise her product and she no deliver on di job.

Regina for November 2021 bin comot to say she neva ever use Kayamata and dat she don end every relationship wey she get wit Jaruma.

Jaruma bin respond to dat claim say she no use kayamata and refer to di oda wife of Ned Nwoko wey bin comot di marriage.

She bin blame di whole palava on di fact say Daniels fail to keep to dia business deal.

Jaruma also tok for inside one video wey she post for her social media handle say she no happy about how 74-year-old Ned Nwoko wey pipo respect fit come social media dey tok bad tins about im wife wey im marry for many years.

Na dia Ned Nwoko take respond and wash hand comot di mata and warn Jaruma ontop di mata.

Di mata take anoda level wen Ned Nwoko file petition and dem arrest Jaruma and charge am to court.

Di Police lawyer, E. A Inegbenoise, bin tell court say Ned Nwoko, Regina Daniel husband bin write petition from im lawyers to di FCT Police Command for proper investigation on January 20, 2021.

Sake of dis allegation, di police lawyer, Inegbenoise bin make case say make di judge keep am for custody so as to make dem cari out proper investigation.

Jaruma for court

BBC
Jaruma for court

Who be Jaruma?

Hauwa Saidu Mohammed wey pipo sabi as Jaruma na Nigerian sex therapist and entrepreneur.

Dem born her for October 26, 1993.

She come from Gombe state and many reason her as di most successful and highest-paid sex therapist for Nigeria.

Jaruma school for Nigeria and Turkey.

She bin start her entrepreneurship career for 2010 as she engage for some businesses but na for 2016 she enta limelight afta she do one video to educate Nigerians about di therapeutic advantages of Azanza Garckeana plant (Silky Kola).

She begin sell sex enhancers products, kayamata wey she claim say dey save women from experiencing failed marriages because dem no fit meet wit di sexual demands of dia partners.

Although some pipo don accuse her say dey add juju to her products to enable her clients fit trap men wey go dey do dia bidding once dem meet.

Who be Ned Nwoko?

Ned Nwoko na former Nigerian lawmaker, lawyer and philanthropist.

E dey married to popular Nollywood actor Regina Daniels.

Daniels bin don always dey for public eye as she begin feature for Nollywood feems since wen she dey small.

However wetin make pipo really sabi her na her marriage to Nigerian billionaire wey old pass her, wey also don get oda wives.

For 2019, 59 years old Ned Nwoko marry Regina wey be 19 as at aat time.

Dis bin generate mixed reactions that time sake of di age difference as many pipo question di actress motivations.

Regina and Nwoko welcome dia first child together June 2020.