Tinubu on 2023 presidency: Wetin di APC leader mean wen e say im ‘ready to fight dirty’?

Presidential candidate for di Nigeria 2023 general elections, Ahmed Bola Tinubu don clarify wetin im mean wen im say “I ready to be dirty.”

Na mixed reactions bin follow Nigeria media reports wey quote di former govnor and national leader of di ruling All Progressive Congress party as telling Olubadan-designate, Dr Lekan Balogun say:

“I dey out to become president of Nigeria. No intimidation, no blackmail fit stop me. I don read about one Greek philosopher say if you wan fight pig, you must ready make dirty rub you – and I ready to dey dirty.”

Tok wey some Nigerians bin interpret as say Oga Tinubu ready to do anytin to become president.

But, Tinubu tok tok pesin, Tunde Rahman, say wetin Oga Tinubu mean be say, im know say by going into politics and declaring in interest to become president im go dey under attack.

“Di mere fact say im agree to join politics and im ready to contest for di presidency, mean say im ready to be dirty, dat na exactly wetin im bin dey tok. Im no dey beat any drum of war.

“A lot of pipo dey tok say, if you no wan dirty no wrestle wit pig, if you no wan dirty, no wrestle wit pig.

Oga Rahman also add say, “by going into politics and declaring im interest to contest for di presidency, im sabi say all dis attacks, all dis mudslinging go come and im ready for dis mudslinging, and im ready to dey dirty as par going into politics and joining di race for di presidency.

On Sunday 20 February, Bola Tinubu bin visit Olu Badan-designate for im Alarere house for Oyo state.

Na for dia e bin make di comments wey begin dey trend.

Tinubu declare to contest

Afta plenty suspense on weda or not Oga Tinubu dey interested to become di next Nigeria president, di APC national leader formally confam say im go contest di 2023 presidential election on January 10, 2022.

E make im interest public afta im close door meeting wit President Muhammadu Buhari, wia im tell am about im presidential ambition.

Im na one of di main candidates wey don declare intention to contest to take ova from Buhari.

Odas na former Imo state govnor and currents ervind Senator, Rochas Okorocha, Ebonyi state Govnor, David Umahi and di Chief Whip of di Senate, Orji Uzor Kalu,

But, Tinubu still need to face di mata of di nominatio from im party as flag bearer, situation wey neva clear weda im go succeed or not.

Who be Bola Ahmed Tinubu?

Bola Ahmed Tinubu alias Jagaban, na man of many parts and im don dey very active for Nigeria political life for many years now.

Di 69 years old get reputation as a political godfather wey dey use im power and influence to support im candidates.

Im na accountant wit degree from Chicago State University for United States, and im work for major companies including Mobil Oil Nigeria before im win senate seat for 1992.

E later go on exile during di rule of military goment sake of im bin dey involved wit di pro-democracy National Democratic Coalition.

Afta di death of military leader General Sani Abacha, im return for 1998 and immediately return to politics.

Bola Ahmed Tinubu na two term govnor of Lagos state from 1999 to 2007.

Although im bin no hold any political office afta 2007, im bin dey groom Lagos state govnors since den.

Jagaban describe imsef as “talent hunter” wey dey “put talents for office, I help dem,” im tell tori pipo Reuters for 2015 during Lagos govnorship election.