Hanifa Abubakar murder: Alleged killer of 5 year-old Kano girl beg make goment give am lawyer

Abdulmalik Tanko di main suspect for di kidnap and murder of five year-old Hanifa Abubakar tell court on Monday say e no get lawyer and dey beg goment to provide am with one.

Na last month Nigeria Police arrest 3 suspects for kidnapping and killing Hanifa after dem discover her dead bodi inside Northwest Preparatory school for Kano city.

Abdulmalik wey be Hanifa school proprietor appear for court with two oda suspects but as e be say dem no get lawyer di case no carry on as many dey expect.

“I no get lawyer at di moment because we no get access to anyone but i dey beg goment to provide me with one.” Dis na wetin Abdulmalik tok

Di two oda suspects Fatima Musa and Hashim Isyaku also maintain wetin Abdulmalik tok regarding needing a lawyer.

Judge Sulaiman Na Abba say e don adjourn di case to 14th February 2022 by 2pm Nigerian time.

Prosecution lawyer Musa Lawal s

BBC

Prosecution lawyer Musa Lawal say goment go provide dem with lawyer by next week Monday wey di case go get anoda hearing.

‘Her final moments’

Abubakar Abdulsalam wey be Hanifa father say dem still dey always think about wetin happun but at di same time know say na test from God, say as Hanifa prepare to comot for school on dat particular Saturday she come meet am.

“She come meet me say she don prepare for Islamiyah (Islamic school) I come tell her say make she pray and for my presence she come repeat di prayer.”

“Afta, she turn to di mother tell her say mummy, if you dey come back from market helep me buy Alewar madara (milk candy).”

Dat na di final moments Abubakar spend with im daughter.

“Wetin I go dey always remember about her na day Hanifa na very lively and smart girl, all di neighbours love her and her father na her favourite.” Abdulsalam tok.

Cases of missing children in Nigeria

E dey difficult to place actual number ontop di cases of children wey dey miss for Nigeria through kidnappings and abductions wey no relate to banditry and Boko Haram.

But e dey hapun and tori dey come out about am well-well.

For 2nd of August 2021, 32-year-old Bilikisu Salisu also become victim. She say dem steal her three year old pikin-Kusina Salisu.

E happun for Dakwa Community near Deidei for Bwari Area Council of Abuja, Nigeria capital.

She bin send di pikin and her sister to go buy pepper for her to make food- dem go buy di pepper come back house.

She come later go out to play around 5-6 pm and no return home again till date.

Also for 2021, some mothers for Kano state (northern Nigeria) hold protest over dia missing 118 children and dem feel say authorities no dey do anything on di mata.