Rochas Okorocha: EFCC sama former Nigerian governor wit 2.9 billion naira fraud allegations

Di Economic and Financial Crimes Commission EFCC don charge former govnor of Imo state, Rochas Okorocha, wit allegation say e joinbodi wit politicians and five companies to steal 2.9 billion naira from public funds.

According to EFCC, Okorocha wey also dey serve as Senator allegedly divert di moni between October 2014 and February 2016 from di Imo State Government House account and Imo State Joint Local Government Project account.

Okorocha never respond to di allegations.

EFCC tok-tok pesin, Wilson Uwujaren confam di tori to BBC Pidgin say di commission file di 17 charges on Monday for Federal High Court, Abuja.

Di charges dey come hours wen oga Okorocha declare im intention to run for di office of di president for 2023.

No be only oga Okorocha EFCC dey accuse, dem also name odas wey allegedly involve for di matter.

Oga Okorocha bin win di Imo state gubernatorial election for 6 May 2011 and dem vote am again for second term for 11 April 2015.

Di former govnor now dey represent di Imo West Senatorial District for di red chamber.

Senator Okorocha na di founder of Rochas Foundation, one charity organization wey build schools and dey give children schorlarship for school for Nigeria.

Di Nigeria corruption police don dey drag Okorocha tey-tey on top corruption mata.

For September 2019, Di EFCC claim say dem don get court order to seize some of im property like one 16 blocks of flats, eight bungalow multi million naira estate, hotel two schools, shopping plaza, super market, hospital and four vehicles, most of dem dey di state.

On 13 April, 2021 di Nigeria corruption police operatives bin arrest Okorocha wey represent lmo West senatorial District on for im Unity House office for Garki, Abuja.

For dat time dem accuse am of embezzlement and misappropriation of funds but dem later release am days later.