Ivory Coast vs Egypt: Egypt comot Ivory Coast from Afcon 2021 to enta quarter final

Mo Sallah

Getty Images

Egypt don beat Ivory Coast 5-4 wit penalty to enta di quarter-finals of di Africa Cup of Nations for Cameroon after 0-0 draw today.

Di North Africans bin get di upper hand for di shoot-out wen substitute keeper Gabaski catch Eric Bailly ball for di third round of di penalty kick.

Pharaohs captain Mohamed Salah naim score di decisive penalty wey send di seven-time champions to di quarter finals.

Egypt go face Morocco for di last eight for Yaounde on Sunday, January 30 (16:00 GMT).

Di match bin dey harsh on Manchester United defender Bailly, who bin perform well for di back as e wear rugby scrum cap sake of say e just return from head injury.

Im be take a short run-up for im penalty and place di ball too close to Gabaski, wey dive to im right and stick out im left hand to push the ball to di bar.

Di Zamalek keeper bin enter at di end of di second half after Mohamed El Shenawy get leg injury.

Gabaski fit start against Morocco but na di extend of di injury wey Shenawy get go determine am.

How di penalty shootout go

Na Ivory Coast first play, na Nicholas Pepe play di first penalty and e score.

Zizo score for Egypt too making 1-1

Ibrahim Sangare score im own as Amr Solia score for Egypt 2-2

Eric Bailly naim first miss im penalty kick for Ivory Coast, e play am go hit bar still 2-2.

Omar Kamal score for Egypt to make ma 2-3.

Maxwell Cornet score im own for Ivory Coast to be 3-3.

Mohamed Abdel Monen score for Egypt to make am 3-4

Wilfred Zaha score too 4-4

Mohamed Salah take di last kick and e score 4-5

Egypt forward Mo Salah and Nicola Pepe of Ivory Coast

Getty Images

Match Statistics

Ball possession Ivory Coast get 55% while Egypt get 45%

Shots Ivory Coast get 13 while Egypt get 21.

Shots on target na 8 to 5 in favour of Ivory Coast.

Corner Kicks, Ivory Coast get 9 while Egypt get 7.

As di match hot reach na so fouls plenti too.

Ivory Coast get 20 while Egypt get 16

Ivory Coast vs Egypt Line up:

Ivory Coast: Badra Ali; Aurier, Bailly, Deli, Konan; Kessié, Seri, Sangaré; Pépé, Haller, Gradel

Egypt: El-Shenawy; Kamal, Hegazy, Abdelmonem, Fetouh; Fathi, Elsulya, Elneny; Salah, Mostafa, Marmoush