Ivory Coast vs Algeria: Mahrez miss penalty afta Nicolas Pepe, Ibrahim Sangare and Franck Kessie score for Ivory Coast to end Desert Foxes Afcon defense

Algeria forward Riyah Mahrez and Pepe of Ivory Coast

Getty Images
Algeria forward Riyah Mahrez and Pepe of Ivory Coast

Defending champions Algeria don comot from di Afcon 2021 tournament.

Di Desert Foxes chop three goals from di Elephants as dem see dia defence of di title wey dem win for 2019 end prematurely.

Na Nicolas Pepe, Ibrahim Sangare and Franck Kessie score for Ivory Coast.

Di Arsenal star Pepe and im Ivorian team mates press Algeria from di start of di whistle to di end – though Algeria get some break in-between.

But Algeria miss dia chance to reduce di deficit afta Riyad Mahrez miss penalty wey hit bar for di match wey happen for di Japoma stadium on Thursday.

Meanwhile, Equatorial Guinea go join Ivory Coast to qualify for Group E afta dem beat Sierra Leone for di oda match afta Pablo Ganet goal.

Algeria finish bottom of Group E without wining any match for Afcon 2021 wit one point.

How di match go

Second Half

Algeria forward Riyad Mahrez react aftA Ivory Coast knack dem comot for Afcon 2021

Getty Images
Algeria forward Riyad Mahrez react aftA Ivory Coast knack dem comot for Afcon 2021

45mins: Second Half start. Ivory Coast 2-0 Algeria.

45mins: Substitution for Algeria. Islam Slimani replace Said Benrahma.

48mins: Di Elephants dey press wit steady run from Sangaré enta Algeria box.

50mins: Aurier dey get plenty space on di right side.

55mins: Goal! Ivory Coast 3-0 Algeria. Pépé score better goal from di right afta e run enter Algeria box from di midfield.

59mins: Mahrez miss penalty. E play di ball hot bar. Algeria get penalty as Belaili goes down inside box.

61mins: Algeria get anoda chance wit a free-kick just outside di area but Mahrez play am go wide wide.

62mins: Substitution for Algeria. Bendebka replace Bennacer.

66mins: Belmadi dey vex wit as Ivory Coast players dey block dia passes.

69mins: Substitution for Ivory Coast. Die replace Sangare and Kanon replace Deli.

71mins: Ivory Coast win free-kick. Pepe play am go wide.

73mins: Goal! Ivory Coast 3-1 Algeria. Bendebka head ball enter net afta Mandi pass.

75mins: Anoda chance for Algeria. Slimani no fit convert di pass wey dem give am.

76mins: Ivory Coast Kessie hit ball enta net but referee say na offside.

77mins: Slimani don ginger Algeria wit continuous run into Ivory Coast half.

80mins: Zerrouki shot from distance deflect im fellow player.

81mins: Subsititution for Algeria Boulaya replace Atal and Benayada replace Belaili.

82mins: Algeria miss anoda chance! Sangare block Brahimi shot.

84mins: Pepe drive forward from right to left for anoda goal scoring attack but Algeria defender block am.

85mins: Substitution for Ivory Coast. Wilfried Zaha replace Pepe.

88mins: Ivory Coast dey ginger dia fans as match don dey finish.

90mins: Full Time. Ivory Coast 3-0 Algeria

First Half

Ivory Coast players dey jubilate dia second goal

Getty Images
Ivory Coast players dey jubilate dia second goal

1min: Kick off. Match don start

2mins: Bennacer start early Algeria attack on di inside-left. E win free-kick dangerous position afta a foul.

3mins: Mahrez free kick hit wall.

4mins: Ivory Coast Konan break go forward from left-back go inside Algeria penalty area before dem bring am down. No penalty.

6mins: Gradel carry ball wan attack but Ivory Coast players block am.

8mins: Ivory Coast chance! Konan collect pass from Gradel and shoot over di bar.

10mins: Behrahma carry ball run through di left and win corner for Algeria.

12mins: Booking. Yellow card for Ivory Coast Sergio Aurier.

13mins: Algeria win anoda corner.

15mins: Mahrez play free kick for Algeria but nobody fit control am.

18mins: vory Coast win free-kick for attacking position afta dem bring Pepe down.

21mins: Aurier concede corner to Algeria on di left.

23mins: Goal! Ivory Coast 1-0 Algeria. Kessie score afta pass from Pepe.

24mins: Pepe wey don dey busy since di game start, continue to worry Algeria.

25mins: Kossonou fall afta Benrahma put am under pressure.

26mins: Gradel win free-kick.

28mins: Algeria win corner on di right but nobody fit convert am.

31mins: Konan open tins up wit better skill on di left.

33mins: Algeria no dey press like team wey wan win. Na Ivory Coast continue to break into Algeria half especially from di right.

35mins: Algeria finally get chance wit ogbonge long ball from Mandi to Belaili but dem fit convert am.

36mins: Algeria win corner on di left.

39mins: Algeria dey try press wit long balls di Ivorians dey block dem.

40mins: Goal! Ivory Coast 2-0 Algeria. Sangaré give Ivory Coast dia second goal afta assist from Serge Aurier.

43mins: Keeper save weak shot from Belaili. Di defending champions hope don dey hang afta Ivory Coast second goal.

45mins: Half time.

First Half don end Ivory Coast 2-0 Algeria.

Ivory Coast v Algeria Line-up:

Ivory Coast: Badra Ali Sangare; Aurier, Kossounou, Deli, Konan, Ibrahim Sangare, Seri, Kessie, Gradel, Haller, Pepe.

Algeria: M’Bolhi; Attal, Bensebaini, Bedrane, Mandi, Belaili, Zerrouki, Bennacer, Mahrez, Benrahma, Bounedjah.

Make you dey refresh dis page as we go dey update am wit live reports of di match wey go start by 1600 GMT.