Cameroon vs Ethiopia: Vincent Aboubakar goals give Cameroon 4-1 victory over Ethiopia

Cameroon forward Vincent Aboubakar dey celebrate im second goal agaisnt Ethiopia

Getty Images

Cameroon captain Vincent Aboubakar don dey top di list of highest goal scorer for di ongoing African cup of Nations (Afcon) 2021.

Aboubakar two second half goals don make am get four goals for di competition.

Im bin score two goals for Cameroon first match wit Burkina Faso on Monday wia di Indomitable Lions win 2-1.

Karl Toko Ekambi also score two goals for di match – one for first half and di oda one for second half.

Ethiopia wey start well for di first half lose concentration immediately di second half start.

Cameroon don become di first kontri to qualify to di next round afta dia victory against Ethiopia.

Di two teams bin meet for Afcon for 1970, wen Cameroon beat Ethiopia 3-2 and for 2016 Nations cup wia dem play goalless draw.

Di match happen for Olembe Stadium for Yaounde.

Second Half

Cameroon players dey celebrate dia fourth goal

Getty Images
Cameroon players dey celebrate dia fourth goal

Second Half don begin Cameroon 1, Ethiopia 1.

47mins: Attempt save. Cameroon keeper save Firew Solomon attempt.

50mins: Nouhou Tolo win free kick for defensive half.

53mins: Goal! Cameroon 2, Ethiopia 1. Vincent Aboubakar score Cameroon second goal wit header.

55mins: Goal! Cameroon 3, Ethiopia 1. Vincent Aboubakar score again for Cameroon to make am three

56mins: Substitution for Cameroon. James Léa Siliki replace Jean-Eric Maxim Choupo-Moting.

58mins: James Léa Siliki miss anoda attempt for Cameroon to score.

59mins: Foul by Michael Ngadeu

62mins: Attempt save. Keeper save attempt by Karl Toko Ekambi on target.

66mins: Abubeker Nasir win free kick on di right wing.

67mins: Goal! Cameroon 4, Ethiopia 1. Na Karl Toko Ekambi score from di centre of di box to di bottom left corner.

69mins: Substitution for Cameroon. Clinton N’Jie replace Nicolas Moumi Ngamaleu.

71mins: Offside, Cameroon. Vincent Aboubakar try through ball, but André-Frank Zambo Anguissa dey offside and referee catch am.

72mins: Substitution for Ethiopia. Bezabih Melayu replace Mesud Mohammed.

73mins: Substitution for Ethiopia. Ahmed Reshid replace Ramadan Yusef.

73mins: Anoda substitution for Ethiopia. Shemekit Gugesa replace Dawa Hotessa.

79mins: No hat-trick for Aboubakar as dem replace am wit Stéphane Bahoken

83mins: Foul by Clinton N’Jie.

85mins: Ethiopia keeper bloack anoda goals attempt by André-Frank Zambo Anguissa.

86mins: Martin Hongla miss attepmy afta im shot from di centre of di box go too high.

87mins: Ethiopia midfielder Bezabih Melayu miss goal attempt from di centre of di box.

89mins: James Léa Siliki win free kick for di defensive half.

90mins: Collins Fai hit di bar afta im right leg shot.

90mins+1: Cameroon concede corner.

Full Time: Cameron 4, Ethiopia 1

First Half:

Two Cameroon players dey try tackle Ethiopia forward Abubeker Nassir

Getty Images
Two Cameroon players dey try tackle Ethiopia forward Abubeker Nassir

Kick off: Di game don start and na Jean Jacques Ndala Ngambo be di referee

1min: Abubeker Nasir win free kick on di left wing.

4mins: Goal! Ethiopia score

Cameroon 0, Ethiopia 1. Dawa Hotessa score for Ethiopia wit shot wit im right leg from di centre of di box.

7mins: Yellow card for Jean-Eric Maxim Choupo-Moting of Cameroon for bad foul.

8mins: Attempt save. Keeper save Vincent Aboubakar shot.

8mins: Goal! Cameroon 1, Ethiopia 1. Karl Toko Ekambi header from di left side of di six yard box give Cameron equaliser.

10mins: Nouhou Tolo win free kick for di defensive half.

12mins: Yellow card for Martin Hongla of Cameroon for bad foul.

15mins: Nicolas Moumi Ngamaleu win free kick on di right wing.

15mins: Yellow card for Surafel Dagnachew of Ethiopia for bad foul.

17mins: Attempt miss. Martin Hongla right leg shot from outside di box go high.

19mins: Martin Hongla win free kick on di left wing.

21mins: Attempt miss. André-Frank Zambo Anguissa shot from a difficult angle and long range go high and wide to di right from a direct free kick.

22mins: Attempt miss. Abubeker Nasir of Ethiopia miss goal afta shot from outside di box.

24miss: Attempt miss. Dawa Hotessa right leg shot from di centre of di box miss go right.

25mins: Abubeker Nasir win ree kick for di defensive half.

27mins: Karl Toko Ekambi of Cameroon win free kick for di attacking half.

28mins: Attempt miss. Jean-Eric Maxim Choupo-Moting use left leg shoot from di centre of di box.

29mins: Nouhou Tolo win free kick for di defensive half.

32mins: Offside, Cameroon. Karl Toko Ekambi try im luck on a through ball, but Nicolas Moumi Ngamaleu dey offside.

34mins: Cameroon get corner wey Ramadan Yusef concede.

37mins: Nicolas Moumi Ngamaleu win free kick on di right wing.

39mins: Aschalew Tamene Cameroon anoda corner

39mins: Karl Toko Ekambi hit left post wit header from di centre of di box.

43mins: Amanuel Yohannes win free kick for di defensive half.

44mins: Ethiopia get corner wey Nouhou Tolo conceded.

45mins: Foul by Martin Hongla of Cameroon.

45mins: Substitution. Ethiopia. Firew Solomon replace Surafel Dagnachew.

45mins+1: Referee Jean Jacques Ndala Ngambo end first half.

Half Time

First Half end: Cameroon 1, Ethiopia 1.