Morocco vs Ghana: ‘Unlucky’ Ghana ready to end Afcon yawa?

Black Stars

Getty Images

Ghana no fit win de Afcon since 1982 na in captain Andre Ayew talk sey ino bi any problem wey dey worry de Black Stars but na luck wey dem no get.

De Black Stars dey for Group C plus Morocco, Guinea den Comoros.

Na de North Africa boys bi de ones wey Ghana go meet for Monday inside de Ahmadou Ahidjo Stadium for Yaounde. In go open door show sey the Black Stars go fit do well for inside Cameroon or luck go vanish for dema canp inside again.

Ghana vs Morocco game for de 42,000 capacity stadium na im pipo dey talk say go be de proper big game opener for de tournament.

Already Morocco go play di Afcon minus dema star player Hakim Ziyech as coach Vahid Halihordzic talk say de Chelsea player no dey show commitment for hin country side wey Covid don catch plenty of dema players.

Ghana coach go thank God sey na hin do get that problem because after dem do covid test, Ghana go come out clean mean say covid no dey demma camp.

Ghana don attend de Afcon 23 times wey claim de trophy four time inside 1963, 1965, 1978 and 1982 but Morocco attend 18 win only one for inside 1976.

Morocco don win de Afcon once for 1976 and dem take part for de competition 17 times.

Players to watch out for

Andre with his brother Jordan Ayew

Getty Images
Andre and Jordan Ayew miss Ghana’s 5-1 World Cup qualifying win for Congo Brazzaville

Former captain Asamoah Gyan no go play this Afcon but Andre Ayew go lead new Black Stars players Kamaldeen Sulemana, Fatawu Issahaku, Joseph Paintsil, Mohammed Kudus who has remain for hin club talk say hin get injury.

Ghana don include five players from de Ghana local league na de youngest player Fatawu Issahaku who win best player for de Africa U-20 Championship bi de player wey everybody for Ghana dey talk say e go blow for dis tournament.

Morocco complain say covid dey worry demma players including Soufian Boufal who dem dey expect replace Hakijm Ziyech but still players like Paris Saint-Germain’s Achraf Hakimi, Barcelona’s Ez Abde and Wolve`s Roman Saiss, the captain who come talk say all Moroccans expect them to win something.

Meetings between Ghana & Morocco

Ghana vs Morocco

Getty Images
Ghana and Morocco bin meet for Afcon for 2002

Dis titanic Group C opener be de 12th time wey Ghana don meet Morocco for competitive game top. Ibi Morocco wey carry more wins for that inside as dem win five times wey Ghana win three.

De first time wey de two teams meet na way back 1961 as dem play 0-0 draw for World Cup qualifiers.

De big one wey Ghanaians never go forget be de match wey Morocco come play 2-2 plus Ghana in Kumasi wey commot de Black Stars from de 1998 World Cup qualifiers.

Na for de Afcon group stage, dis be de fourth time de two sides dey meet as dem clash after meeting in de 1980, 2002 and 2008, de last one wey Ghana host den beat Morocco 2-0 for Accra come top the group.

Ghana coach Milovan Rajevac don meet Morocco coach Vahid Halihordzic one time for Afcon inside in 2010 wehn Vahid dey coach Ivory Coast, im team den whip Ghana 3-1 carry victory in Angola.

Morocco vs Ghana prediction

John Paintsil

Getty Images

Former Ghana defender John Paintsil tell BBC Pidgin sey hin know de match go be tough but he dey see Ghana carry de day wit slim margin. He predict say Ghana go win 2-1 or 1-0.

Morocco possible starting lineup: Bounou; Hakimi, Saiss, Aguerd, Tissoudali; Amrabat, Fajr, Barkok; Munir, Boufal, En-Nesyri

Ghana possible starting lineup: Wollacot; Djiku, Armatey, Rahman, Mensah; Partey, Wakaso; Andre Ayew, Suleymana, Kudus; J Ayew