Merry Christmas wishes images: Celebrities fotos for Xmas 2021 celebration

Merry Christmas wishes images: Nigerian, global celebs dress for Christmas celebration

BBC
Celebrities celebrate Christmas wit fotos

Many celebrities across di world don ready for di Christmas celebration wey be December 25.

And dem don dey show dia readiness wit adorable photos wey dey light up social media.

BBC Pidgin go on social media to bring fine photos of some of dis celebrities wey dey show say dis Christmas go make sense wella.

Tonto Dikeh

Nollywood actress Tonto Dikeh no dull herself as she don dey readi for Christmas celebration since days ago.

Di ogbonge actress and her son wear red clothes and take photos inside snow costume as dem shine dia teeth for di camera.

Tracey Boakye Christmas foto

Ghanaian actor and entrepreneur Tracey Boakye also share lovely foto of how she don set for di Christmas wit her family.

Mzbel Xmas foto

Ghanaian Hiplife artist Belinda Nana Ekua Amoah, popularly known as Mzbel share casual outfit of she and her fam.

Shawn John East

American former artistic gymnast and Olympic gold medallist Shawn John East also don show say she dey in di Christmas mood.

Di woman and her family bin light up social media with beautiful Christmas photo.

For di photo wey she share on her Instagram page, Shawn and her husband including dia two children wear clothes wey get red as dem pose for di camera.

Funke Akindele

Funke Akindele, wey pipo know as Jenifa bin go on her Instagram page to post one photo where she wear short black gown ontop white sneakers and red socks.

Di Nigerian actress bin rob red lipstick and smile for di camera. Her smile show say Jenifa no fit wait for di Christmas celebration.

“Everything palash! Everywhere Biza Biza,” she write on her Instagram page.

Iyabo Ojo

Popular Nigerian Nollywood actress Iyabo Ojo sidon ontop one red chair wey make am look like a queen as she wish her fans Merry Christmas in advance.

Di versatile actress wear one brown gown wey get black net for di bottom and she match am wit brown shoes and brown purse as she cross leg ontop di chair.

Lizzo Christmas dress

American singer Melissa Viviane Jefferson, known professionally as Lizzo don share foto of how she dress like Christmas Queen.

Duchess of Cambridge

Catherine, Duchess of Cambridge bin post one beautiful photo of hersef for Instagram where she bin dey decorate Christmas tree as she wear red clothe.

Di Duchess of Cambridge tok say she dey excited say she go host people on Christmas for Westminster Abbey.

She say di place dey really special to am and her husband William.

Sofia Vergara

Colombian-American actress Sofia Vergara also don set for Christmas as she post one beautiful photo of hersef for her Instagram page.

She bin wear brown gown as she dey readi to enta one Christmas party.

“I celebrate festive season with una”

Bobi Wine

Politician and presidential candidate for Uganda, Robert Kyagulanyi wey pipo know as Bobi Wine also release beautiful Christmas foto wit im family.

“Everytime we come to dis time of di year, I dey look back and give glory to di almighty God wey allow us see today,” na so Wine tok.

Kerry Washington

Hollywood star Kerry Washington write for her Christmas message say; We dey ready for you Santa!

Mariah Carey

Di “All I want for Christmas” diva Mariah Carey pose inside red gown she rock for one short video she post for her verified Instagram page to celebrate di season.

Christmas Day 2021

Happy Christmas Day dey celebrated by mainly Christians in most of di kontris in di world with a view to celebrating di birth of Jesus Christ.

But di 2021 Christmas celebration dey happun inside di coronavirus pandemic wey don dey for about two years now.

On di occasion of dis day, over two billion pipo meaning at least one-third of di world population go celebrate di day.

Though no specific detail on di exact date or year wey dem born Jesus Christ dey inside di holy book of di bible, Christians celebrate Jesus’ birthday on December 25.

Na sake of dis why many pipo dey also celebrate di day on different dates.

Di term, Christmas, translate as ‘mass on Christ day’ – mass na church service of di Catholics’.

Different kontris around di world get different names for di festival.

Dem dey call am Yuletide inside Germany, Navidad in Spanish, Natale in Italian, and Noël in French.

Christmas season na one of di most joyous festival of di year as na dat time of di year wey pipo dey relax, jolly, flex, give gifts, travel, worship, visit friends and families.

Di celebration dey always follow wit decorations, gifts, cakes, correct food, Christmas carol and holiday.

Na also dat time of di year wen pipo dey come togeda to say bye-bye to di year, welcome di new year and pray for a peaceful and prosperous new year.