ECOWAS summit in Nigeria: Highlights of West African leaders tok for Abuja

Di leaders of di Economic Community of West African States (ECOWAS) hold one ordinary summit on Sunday 12 December for Abuja, Nigeria capital.

Dis meeting, di 60th ordinary session of di Authority of Heads of States and goment dey come afta ECOWAS leaders impose travel bans on members and families of di military junta for Guinea during dia extra-ordinary summit for September.

Di Heads of Authority and goments afta dia summit release 52 point final communiqué wey dem address issues for di region.

Some tins dem discuss

Adoption of ECOWAS vision 2050

Di summit adopt di ECOWAS vision 2050 of “a new community of pipo wey dey fully integrated in a peaceful, prosperous region with strong institutions wey respect fundamental freedoms and work for inclusive and sustainable development”.

Di authority instruct di president of di commission to prepare di operational documents quick quick wit appropriate plans wey go accompany di implementation of Vision 2050.

Peace and Unity

Di Authority commit im sef to promote peace, security and stability for di region as sometin wey dey needed for economic integration and development of di region.

Di Authority show strong concern about di transition process for Guinea and Mali, as dem note di absence of clear signals wey show di restoration of constitutional order wey dey in line with di decision of di Authority.

For Mali mata, di Authority dey vex say di deadline of 27 February 2022 wey dem fix for elections to hold fit no happun, di Authority dey worry over di risk for di region and di intervention of private security companies for Mali. Dem uphold di initial sanctions wey dem put for Mali already.

Security for di region

Di Authority dey worry about di security situation for di Sahel, di terrorists attack dem wey dey happun for Burkina Faso, Mali, Niger and Nigeria. Dem condemn di attacks and condole wit di affected kontris.

Di Authority say dem no go stop to fight against terrorism and continue joint operations around di borders of frontline kontris.

Dem put di deadline to start implementation of di framework to stop terrorism for di region for di 2020-2024 plan.

Monetary Union

Di Heads of state tell member kontris to take necessary steps to comply with di provisions of di Macroeconomic cand stability agreement between ECOWAS member states from 2022.

Di Authority note di financial report of di Special fund wey go finance di activities of di revised roadmap for di ECOWAS single currency.

Dem direct di president of di commission to strengthen collaboration with di Central Banks of di community to make sure say dem get adequate funding for di implementation of di activities of di road map for di launch of di ECO for 2027.

Di Heads of State and goment go hold dia next ordinary session for Accra, Ghana

Na di president of Ghana na im chair di session.

Di ogbonge pipo wey attend dis session na Jose Maria Neves, President of Cape Verde, Alassane Quattara, President Republic of Côte d’Ivoire, Nana Addo Daniela Akufo-Addo, President of Ghana, Umaro Sissoco Embalo, President, Republic of Guinea-Bissau.

Odas na Mohammed Bazoum, President of Niger Republic, Muhammadu Buhari, President of Nigeria, Macky Sall, President of Senegal, Julius Maada Bio, President, Sierra Leone.

Faure Essozimna Gnassingbe, President of Togo, Mariam Chabi Talata, Vice President of Benin, Dee Maxwell Saah Kemayah, Minister of Foreign Affairs, Liberia and Piabie Firmin Grejoue N’do, Ambassador of Burkina Faso to Nigeria.

Oda pipo wey attend di session na former President Goodluck Jonathan wey also bi ECOWAS mediator for Mail.

Jean Claude Kassi Brou, President of ECOWAS Commission and odas.

Di Economic Community Of West African States (ECOWAS) na regional group of fifteen countries, wey dem establish in 1975. Dem say “dia mission na to promote economic integration inside “all fields of economic activity, especially industry, transport, telecommunications, energy, agriculture, natural resources, commerce, monetary and financial questions, social and cultural matas.”

Di ECOWAS Commission dey headed by a president with vice president as deputy. Di president dey also get epp to carry out im duties by Commissioners and di Auditor General wey dey handle different sectors.