Most powerful passport: Global Passport Index 2021 put Nigeria below Ghana, odas – See Visa free kontries like Barbados, Nigerians fit travel to

Collage foto of Buhari and Nigeria passport

State House/Getty
Nigeria International Passport dey ranked as di number 103 for di world while Japan dey number one and pipo wit Japanese passport fit travel to 192 kontris witout visa [visa-free].

Di latest global passport index don rank Nigeria 103 out of 116 kontris wey get di most powerful international passport for di world.

Dis na according to di Henley Passport Index wey describe diasef as di original, authoritative ranking of all di world passports according to di number of destinations di holder fit enta without visa for bodi.

Dem follow tok say di index dey based on exclusive data from di International Air Transport Association, Iata.

For inside di 2021 report, Ghana dust Nigeria as dem be number 84.

Nigeria passport holders only fit enta 45 kontris visa-free wey put dem for number 103: position wey dem dey share wit Ethiopia.

See list of some kontris Nigerian passport holders fit enta witout visa or get visa on arrival.

Ghana Ecowas passport

Getty Images
Ghana Ecowas passport

Dis na kontris Nigerians fit enta witout visa

Barbados (visa free for six months): Barbados na small island kontri wey dey south-eastern Caribbean Sea. Dia neighbour na Saint Lucia, Saint Vincent and di Grenadines, and Trinidad and Tobago.

Di kontri dey spend Barbados Dollar. 100 cents na im make one Barbados Dollar. Di kontri don dey spend dis currency since 1935.

Bridgetown na im be di capital of Barbados. According to Data Commons, Babardos population as at 2020 na 287,371.

English na di official language of Barbados, and dem dey use am for communications, administration, and public services all over di island. But for many Barbadians, Bajan Creole na dia language of everyday life.

Tourism na im be di kontri major source of income. Dia president na Dame Sandra Mason.

Dominica (visa free for 21 days): Dis na island kontri for Caribbean. Dia capital na Roseau and di kontri dey spend East Caribbean dollar.

According to Data Commons, Dominca population as at 2020 na 71,991.

Di president of di kontri na Charles Savarin.

Saint Kitts and Nevis (visa free for 90 days): Saint Kitts and Nevis na island kontri for West Indies. Di kontri na commonwealth realm and na Queen Elizabeth II na im be dia queen and head of state.

Di kontri dey spend Eastern Caribbean dollar and dia Prime Minister na Timothy Harris.

Ghana (visa free): Ghana na kontri for West Africa and Nana Akufo-Addo na im be dia current president.

Di kontri currency na Ghanaian cedi. Ghana na im be di second most populous West African kontri afta Nigeria with population of over 31 million.

Accra na im be di largest city for Ghana. Dia official language na English.

Liberia (visa free) Liberia na West African kontri with over 5 million pipo. Na former footballer George Weah be dia president and di capital na Monrovia.

Di kontri dey spend Liberian dollar and dia main source of income na mining (iron ore and gold), rubber processing, palm oil processing, and diamonds.

See di oda kontris wey Nigerians fit enta witout visa:

Benin (visa free)

Cote d’Ivoire (visa free)

The Gambia (visa free for 90 days)

Guinea (visa free)

Guinea-Bissau (visa free for 90 days)

Haiti (visa free for 90 days)

Mali (visa free)

Niger (visa free)

Senegal (visa free)

Sierra Leone (visa free)

Togo (visa free)

Vanuatu (visa free for 30 days)

See di kontris wey dey offer Nigerians visa on arrival

Bolivia

Comoros

Djibouti

Ethiopia

Gabon

Iran

Kenya

Lebanon

Lesotho

Madagascar

Malawi

Maldives

Mauritania

Mauritius

Mozambique

Namibia

Palau

Rwanda

Samoa

Seychelles

Somalia

South Sudan

Suriname

Tuvalu

Uganda

Seychelles bay

Getty Images
Seychelles na im get di strongest passport for Africa

Di strongest passport for di world

Japan follow wit Singapore get di strongest passport for di world, as anibodi wit dia passport fit enta 192 kontris visa-free.

Germany and South Korea tie leg for number two strongest passport as you fit enta 190 kontris witout visa if you get dem.

United Kingdom and United States of America join chop 7th position wit 185 visa free kontris to enta.

Canadian passports be di 8th strongest.

Meanwhile, despite say na im be di smallest kontri for Africa, Seychelles get di strongest passport for di continent and dem be number 29 on list.

If you get Seychelles passport, you fit enta 152 kontris witout visa.

Botswana follow be 2nd and Namibia be 3rd wit access to 86 and 78 kontris respectively.

Afghanistan passport holders fit only enta 26 kontris without visa and dis one put dem last for di 2021 Henley Passport Index rank at 116.