Lamine Diack IAAF: Former Head of world athletics wey chop sentence last year don die at di age of 88,

Lamine Diack

Getty Images

Di former president of World Athletics (fomerly International Association of Athletics Federations, IAAF), Lamine Diack don die at di age of 88.

Diack wey bin chop conviction last year sake of corruption die for im house for Senegal on Friday.

Diack son announce di death of im papa to Reuters.

According Diack son, Papa Massata Diack, im papa “die at home of a natural death”.

Dem go hold Diack burial later on Friday.

Wen dem convict Diack for corruption, im lawyers bin say he get poor health, say he go die if dem send am go prison.

Dem put am for house arrest and release am on bail dis year. Na di owner of Jaraaf, Cheikh Seck pay 500,000 euro ($565,000 or £425,000) bond wey dem take release am.

Di owner of di football club wey dey Senegal say Diack na good man and great leader.

“Im be good man and great leader. We bin wan make he come back home. Na one month e take us (to gather di 500,000 euros),” Seck tok after Diack die.

Wetin Lamine Diack do wey im chop sentence?

For September 2020, court find Diack guilty say he bin collect bribes from Russian athletes wey dem suspect of using drugs sake of say he won cover up dia test results.

French Court also find Diack guilty say e collect Russian money to finance di 2012 presidential campaign of Macky Sall for Senegal. Court say Diack enter dis mago-mago sake of say he won slow down anti-doping procedures.

Diack bin also ask for bribe wey reach €3.45m from athletes wey dem suspect of using drugs. Court say Diak give officials of IAAF money to cover up for di athletes. Di court give Diack four years prison sentence but two years bin dey suspended.