Fuel Subsidy Update: “We go shut down Nigeria if goment remove subsidy” – NANS

Petrol attendant wey dey pour fuel inside moto.

Getty Images

“Nigeria go close down if di federal goment attempt to remove di fuel subsidy as dem don allegedly propose”

Dis na wetin di President of National Association of Nigerian Student (NANS) Sunday Adedayo Asefon don hala give federal goment say di union go close di kontri if federal goment remove fuel subsidy.

E say dis na di time to respond to goment, especially for wetin di minister of finance, budget and planning, Zainab Ahmed tok say di goment get intention to remove fuel subsidy by February 2022 and give di poorest 40 million pipo transportation moeny of five thousand naira (N5,000) each.

“I tok am again, Nigeria go close down if di federal goment attempt to remove di fuel subsidy as dem don allegedly propose” E hala again.

Asefon also highlight say dis no be di right time for di goment to dey tok fuel subsidy mata as price of tins dey rise upandan plus average Nigerians no dey make beta salary.

“Anoda part wey dey worry us na di plan of goment to pay 40 million poorest Nigerians, N5,000”, na so e tok.

“If goment dey sincere and true true dem wan do dis tin for di interest of evribodi for di kontri, dem tok say di money dem dey pay evri year for subsidy na 1.8 trillion naira, and dem say dem go pay 40 million pipo five thousand naira each, wen we calculate am wit na 2.8 trillion naira evri year na im goment go spend, wayo dey evriwia.”

Protesters

Getty Images
Kontri pipo for Nigeria bin do nation-wide protest for 2012 against former President Jonathan plan to comot fuel subsidy

“Di 2.8 trillion naira wey goment wan pay Nigerian evri year for transport na anoda window of corruption.”

Asefon say dem dey wonda hiw di goment wan take select di 40 million pipo wey go get di benefit for system wey no get beta database to know di number of citizens and competent classification of pipo wey true-true need help.

Condition to remove subsidy

Di NANS presido add say bifor goment go remove subsidy make dem first show goodwill to Nigerians.

E dey beg President Muhammadu Buhari to consider di fuel subsidy removal, say make e look am again well from di eye of Nigerians.

Fuel subsidy: “Government don change mouth” – Odumakin
The British Broadcasting Corporation

E follow hala say di price of cooking gas too don reach di all-time highest for di kontri wey students and pipo no fit buy am again, say make goment chook eye for di gas mata too to help Nigerians now.

“We no dey support wetin di goment dey do.”

Di Nigeria Labour Congress for one statement wey dia President Comrade Ayuba Wabba sign on 24 November, 2021, say tok say dem no dey support di federal goment action.

Dem say di 40 million pipo wey goment wan give five thousand naira na na trap wey go put all Nigerians to suffering wey no go end.

Di Congress advice di goment say make dem protect local consumers from di pressure wey di drop of di Naira go bring plus say make dem make use of local refineries wey dey near and make dem repair di remaining of dem.

Wetin be subsidy and how e take affect Nigeria economy?

Fuel subsidy be sometin wey dem dey call under-recovery and na im be di underpriced sales of petrol.

Di official reason for oil subsidies na to reduce di impact of rising global oil prices on Nigerians.

Fuel subsidy don dey di kontri since di 1970s.

Dem institutionalise am for 1977, under di regime of General Olusegun Obasanjo wit di promulgation of di Price Control Act wey make am illegal for some products (including petrol) to dey sold above di regulated price.

Between 2006-2018 Nigeria spend about 10 trillion Naira on petroleum subsidies.

Goment don try to remove am before?

Since Nigeria transition to civilian rule for 1979, many administrations and regimes don try to comot subsidy.

President Shehu Shagari bin raise di price of petrol in 1982, from 15.3 kobo a litre to 20 kobo.

For 1986 President Ibrahim Babangida announce partial removal of oil subsidies, which see petrol price increase from 20 kobo to 39 kobo per litre. Dis one follow di implementation of di Structural Adjustment Program wey di International Monetary Fund set.

Den for 2012 President Goodluck Jonathan chook hand to remove fuel subsidy pata-pata.

Di mata cause so much gbege and protest sotay di president no do and add 30% back to di fuel price.

For June 2020, President Muhammadu Buhari administration tok say dem sef go remove fuel subsidy as dem follow give approval to di Petroleum Products Pricing Regulatory Agency to remove di price cap wey dey for petrol.

But by March 2021, di government say dem go keep di price di smae even as price of crude dey jump up – which mean say fuel subsidy still dey occur for Nigeria.