Baba Suwe burial ceremony: Babatunde Omidina family tok date wen dem go dey bury di ogbonge Nigerian actor

Baba Suwe

BBC

Tori from Ikorodu Lagos home of Nollywood actor and comedian Babatunde Omidina, popularly known as Baba Suwe be say dem go bury di actor dis Thursday, 25, November, 2021.

According to di family, di burial go hapun for im house wey near Ewu Elepe Bustop, Ijede Road, Ikorodu, Lagos by 10:00am.

Di family don already dig grave wia dem go bury am as at Tuesday morning, 23, November, 2021. Dem also open condolence register beside di grave for visitors.

Sola Omidina confam Baba Suwe death to BBC Pidgin on Monday, 22,November, 2021, say di Nigerian comedian die around afternoon dat day.

Pipo don dey gada small-small for di late actor family house dey wait formal announcement of di burial. Baba Suwe house dey very popular for Ikorodu area of Lagos, as pipo dey see am as mentor.

Baba Suwe family na Muslim family and Muslims no dey waste time to bury pesin wey die, but insider tell BBC Pidgin say some members of di family wey no dey for Lagos say make dem delay di burial till dem arrive.Im first son Sola dey for America wen im papa death happun for Nigeria.

Im bin tell BBC Pidgin say:

“Dem reach out to me immediately e happun, but im (Baba Suwe) bin sick small”.

Baba Suwe bin dey 63-year-old before e die.

Sola describe e papa as a very wonderful pesin and good father.

“E be good father as e entertain di world, e entertain me as a son as well, because wen I dey watch am for screen, I no dey see am as my fada, I dey see as a comedian.”

“E dey funny on screen and funny off di screen. E be di best tin wey don happy to me.”

Baba Suwe colleagues and oda celebrities dey mourn

Former Nigeria Vice President Atiku Abubakar join who dey mourn di ogbonge comedian. E post for im Twitter page where e thank di ogbonge actor for di joy e bring into pipo homes.

Many of Baba Suwe colleagues and oda celebrities dey mourn di actor for social media.

Yomi Fabiyi write on im Instagram page @realyomifabiyi say im go always remember everytin wey im and Baba Suwe tok, di lesson wey im learn from di di veteran actor and di experience.

“I go remember everytin wey we discuss. Di lesson and di experience. Thank you for di opportunity wey you give me for di movie industry. Shock still hold me. Help me greet my mama. Tell am I miss am too and I love am endlessly,” Fabiyi write on Instagram.

Popular Fuji musician Saheed Osupa also react to Baba Suwe death.

Saheed Osupa share foto of di actor on his Instagram page with di handle @kingsaheedosupa and write: “Na life we dey first fear before we fear death. Baba Suwe don die. Rest on Legend.”

Modupe Johnson aka Faliwerepe wey be Baba Suwe colleague write on her Instagram page say make di actor rest in peace. @faliwerepe write: “Rip, Rip, Rip.”

Anoda actor wey im name na Muka Ray also react to im colleague death on im Instagram page. @mukarayofficial write: “Make your soul rest in perfect peace Baba Suwe. E dey sad.”

Sunny Alli also post foto of im senior colleague on Instagram to mourn di death of di popular comedian. @officialsunnyallimadrid write: “Innalillahi waina illaehi rojiun …RIP Baba suwe..”

Who be Baba Suwe?

Dem born Babatunde Omidina aka Baba Suwe on August 22, 1958, for Inabere Street for Lagos Island.

But di legendary actor come from Ikorodu local goment area of Lagos.

E marry e wife, Omoladun Omidina wey also be actor for 1995 and she die for September, 2009.

Di popular actor bin attend Jamaitul Islamial Primary School for Lagos, and Children Boarding School, Osogbo.

After im boarding school, Baba Suwe bin get im West African School Certificate for Ifeoluwa Grammar School for Osogbo, Osun State, southwest Nigeria.

Baba Suwe begin acting career for 1971 and e bin act for both English and Yoruba language films.

Di veteran Nollywood comedian dey often play di role of confuse servant or security guard.

E become popular afta e feature in one movie titled, Omolasan.

Im become more popular afta e act for Iru Esin wey Olaiya Igwe produce for 1997.

Condolence register dey open for im house

BBC

‘Cocaine controversy’

Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) bin arrest Baba Suwe afta dem accuse am of trafficking cocaine for 2011.

As di agency put am for custody sake of say dem want make e excrete di cocaine wey dem suspect say e dey im stomach, nothing come out of Baba Suwe belle.

Di agency chop blame ontop di case and court come judge say make dem pay Baba Suwe more than $155,000 as compensation and apologise to am.

More fotos from Baba Suwe house as dem dey prepare for Baba Suwe burial

Di grave wey dem dig

BBC
Di grave wey dem dig
Pipo dey troop into Baba Suwe house

BBC
Pipo dey troop into Baba Suwe house
Pipo dey sign condolence register

BBC
Pipo dey sign condolence register

We go dey update dis tori as we dey get details.