US Secretary of State visit to Nigeria: Anthony Bliken meeting wit Buhari inside fotos

US Secretary of State dey expected to speak more on di US-Africa policy under di administration of President Joe Biden on Friday, as e continue im Nigeria visit.

Anthony Blinken bin meet wit di President, Muhammadu Buhari, Vice President Professor Yemi Osinbajo and di Minister of Foreign Affairs, Geoffrey Onyeama for Aso Rock, Abuja on Thursday.

E visit Nigeria as part of im tour for Africa wey start for Kenya earlier dis week.

During im meeting wit President Buhari, dem bin discuss di issue of ENDSARS wey dey of concern to plenty Nigerians.

Anthony Bliken on ENDSARS protest

Earlier, di US goment inside statement say dem dey look forward to di Lagos state goment response as e go bring about accountability on di ENDSARS protest and expose wetin really happun for di Lekki Toll Gate on October 20, 2020.

Di US top official describe di report of di Lagos EndSARS probe panel as “democracy in action”

Bliken add say America to get im own share of police brutality and dem dey hope say necessary changes go dey.

However, Nigeria presido assure am say federal goment wan comot body for di mata and go wait for pronouncements from state goments wey don set up panels to torchlight police brutality for di kontri.

“So many state goment dey involved abd dem get difference terms of reference to di probe panels, we for Federal go wait fr di steps wey di states fo take, we gatz allow di system work, we no fit force ideas on dem. Federal goment gats wait for di reaction of di states,” Buhari tok.

Dem also discuss di issue of education, security and climate change.

On di removal of Nigeria from watchlist of kontris wey dey violate religious freedom, President Buharu say freedom of worship dey Nigeria and no dey discriminated against sake of im faith.

Di US Secretary of States also meet wit Vice President Professor Yemi Osinabo.

During di meeting dem sign di 2021-2026 Development Objective Assistance Agreement (DOAG).

Di vice president say DOAG go play ogbonge role in supporting di achievement of di kontri development goals, particularly di one wey concern better healthcare and economic growth.

Fotos of US Secretary of State wit Federal Goment

Wetin US Secretary Anthony Bliken go do for Nigeria

  • US Secretary Anthony Bliken go land Abuja, where e go meet wit President Muhammadu Buhari, Vice President Yemi Osinbajo and Foreign Minister Geoffrey Onyeama.
  • E go further discuss cooperation on global health security, expanding energy access, economic growth and revitalizing democracy.
  • Di Secretary go deliver speech on U.S.-Africa policy for di capital of Africa largest democracy.
  • Bliken go also engage wit Nigerian entrepreneurs for di digital sector.

Nigeria – US bilateral relationship

Nigeria and America relationship don start since 1960 wen Nigeria gain independence from di United Kingdom.

But na afta di 1999 election when di kontri elect democratic goment na im di relationship begin make sense well-well.

US don provide plenty aids to Nigeria and e dey chook mouth for mata wey consign di interest of di kontri like di ENDSARS protest, Covid- 19, security, economy, education, among odas.

Recently, di United States welcome di conclusion of di Lagos State Judicial Panel of Inquiry as dem submit di final report of dia findings give di state goment.

E say dem dey look forward to di Lagos state goment response as e go bring about accountability on di ENDSARS protest and expose wetin really happun for di Lekki Toll Gate on October 20, 2020.

Di US goment add for inside di statement say dem also dey look forward to di measures Lagos state abd federal goment go take to address di serious allegations against some members of di security forces, alleged abuses plus grievances of di victims and dia families.

On Covid -19 vaccine, America don donate over 10 million doses of di coronavirus vaccine give Nigeria through Covax.

Di latest na di 3.5million Pfizer vaccine wey land Nnamdi Nnamdi Azikwe International Airport for Abuja on October 14.

Bilateral Economic Relations

America na di largest foreign investor for Nigeria, wit foreign direct investment for di petroleum/mining and wholesale trade sectors.

Wetin U.S. dey export to Nigeria include wheat, vehicles, machinery, kerosene, lubricating oils, jet fuel, civilian aircraft, and plastics.

Wetin Nigerian dey export go di United States include crude oil, cocoa, cashew nuts, and animal feed.

Nigeria dey eligible for preferential trade benefits under di African Growth and Opportunity Act (AGOA).

Bilateral Security Cooperation

Nigeria na important U.S. security partner for Africa.

Di kontri na vital member of di Defeat ISIS (D-ISIS) coalition and for October 2020, Nigeria co-hosted one online D-ISIS conference wit di United States.

Nigeria Membership for International Organizations

Nigeria and di United States belong to some international organizations wey include di United Nations, International Monetary Fund, World Bank, and World Trade Organization.

Nigeria also na observer to the Organization of American States.

Profile of Anthony Blinken

US Secretary of States Anthony Bliken

BBC

Anthony J. Bliken na di United States of America 71st Secretary of State.

America President Joe Biden nominate am as di Secretary of State on November 23, 2020, di US Senate confam im nomination January 26, 2021 and e dey sworn in by Vice President Kamala Harris January 27.

E bin serve as deputy secretary of state for President Barack Obama from 2015 to 2017.

Before that, e work as President Obama principal deputy national security advisor. For that role, oga Blinken chair di interagency deputies committee, di main forum for hammering out di administration foreign policy.

During di first term of di Obama Administration; Oga Blinken na di national security advisor to di then-Vice President Joe Biden.

During di Clinton Administration, Oga Blinken serve as member of di National Security Council staff, wey include two years as di senior director for European affairs, di president principal advisor on di kontris of Europe, di European Union, and NATO. E also spend four years as President Clinton chief foreign policy speechwriter, plus e lead di NSC strategic planning team.

Oga Blinken public service start for di State Department. From 1993 to 1994, e be special assistant for di Bureau of European and Canadian Affairs.

Outside of goment, oga Blinken don work for private sector, civil society, and journalism.