Abuja-Kaduna train attack: Nigeria Railway Corporation suspend services afta suspected bandits waylay train

Suspected bandits attack one train wey dey travel from Kaduna to Abuja road on Wednesday.

Eyewitnesses don describe wetin dia eye see say na God save dem.

Dis wan make di Nigeria Railway Corporation to suspend train services across di kontri due to security concerns.

NRC make di announcement on dia website on Thursday afternoon afta reports of anoda on anoda train wey dey travel along di same route.

Details of di attack never dey clear, but reports say di bandits use explosive for di attack on di train.

Pictures from di incident show di badly damaged train with broken glasses and holes and di rail wey cut off.

For inside one video wey don go viral, security personnel dey inspect di rail track where di incident hapun.

For inside di video, one voice dey say “dis na complete cut-off, na only God save us oh. look am, look am.

Eyewitnesses say anoda attack happun on Thursday morning for train wey leave Abuja to Kaduna.

‘Di bandits use explosives’

Senator Shehu Sani wey be one of di passengers wey use di train from Abuja to Kaduna on Thursday morning give account of wetin hapun ontop im twitter page.

“Yesterday bandits attack di Kaduna-Abuja train. Dem plant explosive wey damage di rail track and scata di windshield of di train engine. Dem also open fire as dem target di driver and tank. E hapun between di Dutse and Rijana stations.” Senator Sani tok.

Di Senator say di driver struggle to move towards Kaduna Rigasa station.

“Dis early morning, I dey on board wen our run over anoda rail wey explosives damage, di train nearly run comot track, na by miracle we take escape.” Senator Sani tok.

Oda times wey Kaduna- Abuja train come under attack

For September 2020, train wey dey move from Abuja to Kaduna come under serious attack and passengers say dem hear gunshots as di train dey move.

ASP Mohammed Jagile wey be tok-tok pesin for Kaduna Police Command bin comot to say na just some hoodlums throw stones at di train.

For January 2020, anoda incident happun for Katari station (70km to capital Abuja) as some passengers complain of hearing gunshots on dia way to Abuja.

Di Kaduna-Abuja rail

Di Kaduna to Abuja rail na di only active rail wey connect Nigerian capital Abuja to di seven northwest states.

Many Nigerians wey dey travel to Abuja from Katsina, Sokoto or any of di northwest states dey travel to Kaduna by road and from dia enter train to Abuja to avoid Kaduna road wey get many security wahala.

President Muhammadu Buhari commission di train services on 26th July 2016 and e come at a time wey many pipo dey try avoid regular road due to kidnappings and banditry wey dey happun so dis reason make plenty pipo to prefer di train.

For many pipo, dis suspension go put dem inside big wahala as per say some no fit afford to fly to Abuja from some of di northern states and dem also no wan follow di problematic Kaduna road wey don see plenti kidnappings in recent years including di recent one wey involve Emir of Bungudu town.

Isa Sanusi suppose travel to Abuja by weekend from Kano state but e tell BBC Pidgin say e just dey tink of how to go about im journey considering na train e dey always use from Kaduna-Abuja.

“Usually when I dey travel to Abuja, I dey use my car drive to Kaduna from dia I park my car for my friend house den follow train to Abuja but now with dis suspension, I just dey tink how e go be on Saturday because I dey fear to follow Kaduna-Abuja road.” E tok.