Endsars protest: Police make arrests for Endsars memorial protest

Lekki Toll Gate

BBC

Police for Lagos don arrest at least six pipo wey come out to protest on di anniversary of di alleged shooting for Lekki toll gate.

Dis na as police pack dem self for di toll gate afta warning wey tok say make no bodi comot to protest but car procession dey allowed.

Comedian wey dey popularly known as Mr Macaroni and musician Falz bin announce on Monday say protest go hold despite di police warning.

Lekki Toll Gate

AFP

Di protest wey dey hold on Wednesday na to remember wetin happun during di nationwide protest wey rock Nigeria for 2020.

Dis protests bin call for end to police brutality but later suffer hijack by hooldums.

Jaguda pipo begin attack police formations and pipo property.

Lekki Toll Gate

BBC

One of di incident wey happun and become major conversation on 20 October, 2020 na di shooting wey happun for di toll gate.

Tori be say shortly afta sunset, di army bin go Lekki Toll Gate to disperse protesters sake of say di governor of di state don announce curfew.

Lekki Toll Gate

BBC

Instagram Lives and videos bin comot wey claim say di army kill many pipo dat day.

Nigeria army agree say dem do shooting for Lekki toll gate during di protest, but dem say “dem no shoot live bullets dia and dem no kill anybodi dia”.

For di Lagos Judicial Panel wey officially end on Monday, di Police also say nobodi die during di incident.

Lekki Toll Gate

BBC

How di protest hold for Lagos and oda Nigerian cities

For Lagos, many visit di Lekki toll gate, scene of di OCtober 20, 2020 incident.

While some bin wave flags inside dia cars, odas wave fliers and posters wey carry different messages.

Falz during memorial protest

BBC
Musician falz wey bin call for Wednesday memorial protest bin dey present for Lekki toll gate on Wednesday
Youths hold Endsars placard for Lekki

BBC
Youths hold Endsars anniversary placard for Lekki

Oda places around Nigeria dey plan dia own memorial protest too, most notable na Abuja and Port Harcourt.

Endsars protest for Abuja

BBC
Endsars protest for Abuja

For Abuja, youths gather for Unity Fountain for Maitama. Not long afta dem gada, police block dem to stop dia demonstration.

Police block youths for Abuja

BBC
Police block youths for Abuja
Akure protest

BBC
How youths turn up for Akure, Ondo State to mark Endsars anniversary

Meanwhile some groups don also come out to support di police and Army stance say nobody die for Lekki.

Group support police and army statements on Lekki incident

BBC

‘Lekki massacre no dey real’

Nigeria minister of information and culture Lai Muhammed don tok for press conference say di allege massacre no dey real.

Alhaji Lai Muhammed say: “Wey di families of those wey dem reportedly kill for di tollgate? Se dem show up for di Judicial Panel of Inquiry? If no be so, why”?

E say di testimony of ballistic expert before di Judicial Panel of Inquiry contradict wetin CNN and Amnesty International tok say military no fire any  grade live ammunition at protesters for Lekki Toll gate.