Hand don touch di police officers wey tori say dem use intimidation collect money from one young traveller along di federal highway for Kogi state, North Central Nigeria.
Di arrest of di officers happen afta Nigeria Inspector General of Police call for investigation into video wey show wia one police officer manhandle di young traveller – di video dey circulate for social media
IGP Usman Baba say make di Commissioner of Police for Kogi State investigate di matter and punish di officer if e dey guilty.
In response to IGP order, di Kogi state police command say dem don arrest di officers wey involve for di incident.
- “Dem torture am, break im legs, Chima die in pain” – Family
- How police bullet allegedly kill 18 years girl for Lagos
“Di Commissioner of Police, Kogi State Police Command, CP Idrisu Dauda Dabban, wey condemn di incident, say dem don identify di police officers.
Di officers dey detention for State Criminal Investigations Department,” William Aya, tok-tok pesin for Kogi state tok for statement.
Wetin dey di viral video?
Tori be say di police officers including dia patrol leader use intimidation collect N25,000 naira from di man.
Di video wey dey circulate online show wia one armed police officer dey slap one young man along di road.
Di video also capture wia some pipo dey beg di officer to leave di young man alone.
Di recorder of di video wey also narrate wetin happen as eyewitness say di incident happun along Okene road for Kogi state.
Di eyewitness wey no mention im name tok for di video say, “See wetin Nigeria police dey do to a citizen of dis kontri.
Dem force one of our passenger down say make e go withdraw money from ATM. All di drivers park dey tell dem say wetin dem dey do no dey right.
Dem dey ask am why e go carry passenger go POS, instead e say blood go flow.
We dey Kogi state and di officer wey lead dem come na Godwin wey wear uniform wey name dey. One pull uniform follow di boy go bank.” E tok.
Police reaction
Di Kogi State Police Command wey dey torch light di mata say di incident happen for Adogo-Okene wia police personnel attached to Adogo Division dey on patrol duty.
Aya say di officers wey involve for di incident na;
- ASP Isah Barnabas
- Inspector Ifediegwu Godwin
- Sgt Emmanuel Ochima
- CPL Umameh Mathias “wey physically assault one of di travellers.”
Di police tok-tok pesin say “di Assistant Superintendent of Police (ASP) don chop official query while di three (3) oda junior officers dey currently undergo orderly room trial.”