Tanker drivers strike: Nigerians avoid fuel scarcity for di kontri afta NUPENG suspend nationwide action

Petrol tanker

Getty Images

Nigeria petroleum tanker drivers don suspend dia nationwide strike wey suppose start on Monday October 11, 2021.

According to di union, na to give dem enough time for negotiations.

Di National Union of Petroleum and Natural Gas Workers bin announce say dem dey on strike to protest di bad condition of roads for di kontri.

Dem add say di situation dey put dia drivers lives in danger.

Nupeng call off dia strike afta dem reach agreement wit Nigeria national petroleum cooperation on Sunday.

Dis move by Nupeng don prevent anoda nationwide fuel scarcity palava for di kontri.

But dem add say dem go do follow up meeting wit NNPC dis week.

NNPC na di goment owned oil company wey dey handle di business of petroleum sector.

Wetin NUPENG tok?

NUPENG explain di reason why dem suspend dia planned strike nationwide.

“Di suspension of our planned action na based on hope and di understanding wey we reach wit goment today as well as our meeting on Tuesday 12th, October 2021 say dem go fulfil all our demands.”

Na wetin NUPENG tok for statement wey di president and di secretary general sign.

Di union add say dem no go hesitate to go on strike again dis time without any notice if goment fail on di agreement wey dem reach for these two meetings within di timeframe dem agree.

But dis no be di first time wey di union don threaten to go on strike sake of bad roads.

Last year, di union bin give federal goment two weeks to fix di bad roads for di kontri.

Dem even list some of di roads dat time wey dem claim say don turn to ‘death trap’.

According to dem, di roads na Calabar-Itu-Uyo, Port-Harcourt-Aba, Mokwa-Jebba-Kaduna, Port-Harcourt-Owerri and di Warri-Benin-Auchi-Okene-Lokoja as di routes wey dey give dia union members wahala pass.

Tori be say for Nigeria di only way to move petroleum products across di kontri na by roads wit trucks.