Nigeria at 61: Buhari lift Twitter ban, wit conditions

Twitter logo for smart fone

Getty Images
Twitter logo

President Buhari don announce di lift of di ban on Twitter but only if di company meet certain condition.

Buhari tok dis one during im independence day speech to Nigerians.

E say recent events don show say di platform no just dey as platform but dey serve as means for information dissemination.

Rather some users don misuse Twitter to organise, coordinate, and execute criminal activities, propagate fake news, and promote ethnic and religious sentiments dat na why gomment ban di platform.

For im speech di President tok say: “Following di suspension of Twitter operations, Twitter Inc. reach out to di Federal Government of Nigeria to resolve di impasse. Subsequently, I constitute Presidential Committee to engage Twitter to explore di possibility of resolving di issue.

“Di Committee, along wit dia Technical Team, don engage with Twitter and don address a number of key issues. Wey include:

  • National Security and Cohesion;
  • Registration, Physical presence and Representation;
  • Fair Taxation;
  • Dispute Resolution; and
  • Local Content.

“Following di extensive engagements, dem dey address di issues and I don direct dem to lift di suspension but only if dem meet di conditions to allow our citizens continue di use of di platform for business and positive engagements.

Di president add say, “As a country, we dey committed to ensure digital companies use their platform to enhance di lives of our citizens, respect Nigeria sovereignty, cultural values and promote online safety.”

Why Nigeria bin ban twitter

on June 5, 2021 di Federal Government of Nigeria bin suspend di operations of Twitter in di kontri.

Di Minister of Information and Culture, Alhaji Lai Mohammed, bin announce di suspension “sake of di persistent use of di platform for activities wey dey capable of undermining Nigeria corporate existence.”

Dem say di ban go allow di Government put measures in place to address dis challenges.

Di decision from Nigeria goment bin come days afta Twitter delete one of di tweets Nigeria President, Muhammadu Buhari bin post on im personal account @MBuhari.

President Buhari bin post thread of tweet wia im address insecurity palava for di kontri.

Im bin issue ogbonge warning to those wey wan destroy di kontri and burn down national asset say “rude shock dey wait dem, very soon…”

Di minister bin also direct di National Broadcasting commission to start di process to begin license all OTT and social media operations for Nigeria.

Meanwhile di social media company bin tok say oga Buhari tweet violate Twitter Rules.