President Muhammadu Buhari at di United Nations General Assembly 76th Session in New York – Wetin you need to know

Nigeria President Muhammadu Buhari land New York, America on Sunday September 19, 2021 ahead of di 76th UN General Assembly.

President Buhari go address di assembly during di general debates on Friday, September 24.

E dey go with delegation wey include di Minister of Foreign Affairs, Geoffrey Onyeama, di kontri Attorney General and Minister of Justice Abubakar Malami (SAN) and Minister of State for Environment Sharon Ikeazor.

Oda pipo wey dey follow for di UNGA Delegation na National Security Adviser, Maj-Gen. Babagana Monguno (retd); Director-General, National Intelligence Agency, Amb. Ahmed Rufai Abubakar; Chairman, Nigerians in Diaspora Commission, Abike Dabiri-Erewa and the Senior Special Assistant to the President on SDGs, Mrs Adejoke Orelope-Adefulire.

Oda meetings wey di Nigerian leader go participate for na;

  • Food Systems Summit
  • High Level Dialogue on Energy
  • Di High Level Plenary Meeting to promote di International Day for di Total Elimination of Nuclear Weapons
  • Di High Level Meeting to remember di 2oth anniversary of di Durban Declaration on Racial Justice

Di statement say di president go come back to di kontri by di 26th of September, 2021.

Dis dey come one month afta im enta back Nigeria afta im visit to London for di Global Education Summit.

Dis na eviritin you need to know di 76th UN General Assembly.

Where di 76th UN General Assembly go take place?

Di 76th UN General Assembly go take place go take place for New York, United States of America.

UNGA go officially open on Tuesday September 21, 2021, wit di General Debate.

Dis na opportunity for representatives from all 193 member states to address di chamber.

UNGA dey serve as di main deliberative and policy-making body of UN, to address ogbonge world issues as well as di challenges facing individual members.

Na di only body for di organisation where all members get representation.

According to UN Charter, di join body work na to address matters of international peace and security wey di UN Security Council no dey torchlight.

E dey also torchlight matters of human rights, international law, and cooperation in “economic, social, cultural, educational, and health fields”.

Wetin go happun dis week?

Di General Debate na UN most prominent annual event, wit world leaders and heads of goments wia dem go gada for di organisation New York City headquarters for nine days of speeches and meetings.

But di work of di new UNGA session bin begin on Tuesday – a week before di debate – wit di official election of incoming UNGA President Abdulla Shahid of di Maldives by di body, as dem replace outgoing President Volkan Bozkir of Turkey.

Shadid don already set di theme for di session wey be: “Building resilience through hope – to recover from COVID-19, rebuild sustainability, respond to di needs of di planet, respect di rights of pipo, and revitalise di United Nations.”

Di Assembly go also appoint officers to di Credentials Committee, dat body na im go determine who di UN recognises as di legitimate representative of a member state.

And di six Main Committees : Disarmament and International Security; Economic & Financial; Social, Humanitarian & Cultural; Special Political & Decolonization; Administrative & Budgetary; and Legal.

Finally, the Assembly go adopt di initial agenda for di year, wey go include planned meetings, future approval of UNSC members, members of the Human Rights Council, and budget approval.

Last year, even wit di pandemic, di UNGA bin hold 103 full-member meetings – and pass 320 resolutions.

Bozkir, wey be di outgoing UNGA president, im final press conference last week, recommend make di assembly work towards f “fewer, more intense” meetings, wit more involvement from world leaders.

Wetin be UNGA?

Every September na when di opening session of United Nations General Assembly dey take place and e don turn to stage where presidents and prime ministers dey give speech.

As e be, na for dia dem dey discuss world peace and oda issue dem wey fit threaten di world.

Di rule be say, small and very big country dem, rich and poor country too get equal voice for inside di Assembly.