Ex-President Goodluck Ebele Jonathan defection rumour dey swell by di day across Nigeria. But na true?
Peoples Democratic Party [PDP] say dem neva receive any official correspondence from di former Nigerian leader on dis mata.
PDP tell BBC Pidgin on Wednesday afternoon say Former President Goodluck Jonathan never inform dem on if he get any plan to comot from di party.
Oga Jonathan serve as Nigeria President from May 2010 till May 2015 under di Peoples Democratic Party.
Nigeria main opposition party clear dis as tori dey fly up and down say Oga GEJ (as many dey call am) don defect to di ruling All Progressives Congress.
“We neva get any fact yet and di rumour don dey since last night.
“Plus dem neva receive any indication from di former president. As party, we neva receive any official confirmation.”
Jonathan wey be Nigeria President from 2010 to 2015 bin serve under di platform of di Peoples Democratic Party.
PDP National Publicity Secretary, Kola Ologbodinyan tell BBC pidgin on Wednesday morning.
Di then, opposition party, APC bin defeat am as e dey seek re-election for 2015.
Di now President, Muhammadu Buhari bin win am for di polls.
Dis make am di first sitting president to chop defeat for Nigeria election.
Oga Jonathan bin call Muhammadu Buhari to congratulate am even before di kontri election body finish to count di result.
Dis move bin make many pipo both home and abroad to see am as as “hero of peace”.
Dem claim say dis im action bin relax di tension for di kontri and don overturn any kain kasala or blood shed wey di kontri for witness.
Wia Jonathan dey now?
Since im defeat for 2015, oga Jonathan don serve di kontri and Africa for plenty peace broker mission.
Di latest na di Guinea coup wey e dey serve as mediator for di West African regional bloc (ECOWAS).
Now e dey follow di military junta tok on wetin go dey best for di region.
Goodluck Ebele Jonathan Profile
Dr. Goodluck Ebele Jonathan na former Nigeria president of Nigeria.
Dem am for November 20, 1957 for Otuoke, Ogbia Local Government of Bayelsa State inside di oil rich Niger Delta.
Im papa, Lawrence Ebele Jonathan na canoe- maker and im mama, Eunice Ayi Ebele Jonathan, na retired farmer.
Oga Jonathan get im education for St. Stephen’s Primary School, Otuoke; St Michael’s Primary School, Oloibiri; Mater Dei High School, lmiringi; Ogbia.
And University of Port Harcourt, wia he receive im Bachelor of Science degree, Master’s degree and Doctorate in Hydrobiology and Fisheries Biology.
Before e join politics, e serve as Science Inspector of Education, lecturer for Rivers State College of Education Rumuolumeni (now Ignatius Ajuru University).
GEJ also work as an Assistant Director for di defunct Oil Minerals Producing Areas Development Commission.
Jonathan political career start wit di return of democracy to Nigeria for 1998, afta di death of General Sani Abacha wey rule Nigeria as military dictator from 1993.
For di run up to di 1998 elections, Diepreye Alaimeyeseigha become governorship candidate for di Peoples Democratic Party, PDP.
Dat time dem bin choose am as Alaimeyeseigha running mate.
Di Alaimeyeseigha/Jonathan ticket win di election.
And e become di first civilian deputy governor of Bayelsa State on May 29, 1999. Dem get re-election for 2004.
Goodluck Jonathan bin serve as deputy governor of Bayelsa state until December 12, 2005.
Dat na wen dem swear am in governor. For 2007 e win di PDP Bayelsa State gubernatorial primary.
And na for di middle of im campaign na im dem nominate am as vice presidential running mate to PDP presidential candidate, Umaru Musa Yar’ Adua.
Di Yar’ Adua/Jonathan ticket win di election.
On May 29, 2007, Dr. Jonathan take di oath of office as Nigeria Vice-President.
Dat na di first time civilian from Nigeria South-South geopolitical zone go hold that kain high political office for Nigeria.
Sake of di long treatment of President Umar Yar’Adua for one hospital for Saudi Arabia, national assembly bin make Goodluck Acting President on February 9, 2010 in line wit di constitution provision.
Afta di death of di President on May 5, 2010, Jonathan dey sworn in as President and Commander-in-Chief of the Federal Republic of Nigeria on May 6 2010, e become Nigeria 14th Head of State.
For 2011, President Jonathan run for presidency as PDP candidate and e win, position wey e hold until 2015.
As President e make major contributions to di political, economic and social development of Nigeria through im Transformation Agenda.
E promote democratization through di observance of di rule of law, enactment of di Freedom of Information Act, electoral reforms and non-interference in electoral outcomes, dey among im many achievements.
For 2015, afta strongly contested presidential campaign and to di surprise of imopponents, e concede victory to General Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress through phone call even before di Independent National Electoral Commission announce di final result.
Dis im action receive commendations from African and Internation community as dem hail am as a statesman.
President Jonathan bin dey in charge of di first peaceful transfer of political power from ruling party to opposition party for Nigeria wit di swearing in of President-elect Muhammadu Buhari as President/Commander in Chief on May 29, 2015.
President Jonathan don receive several local and global awards in recognition of im exceptional public service.
E wan continue to dey promote peace, democracy and development in Africa though di Goodluck Jonathan Foundation where e dey serve as Chairman.
Gooduck don serve as special envoy for di UN and Africa as peace ambassador wey dey try resolve conflicts for regions wey dey troubled.