Kogi Prison break: FG react to gunmen attack for Kogi jail wia over 200 prisoners japa

To escape from lawful custody na serious criminal offence, Rauf Aregbesola, Minister of Interior don tok.

Di Minister also say Law enforcement agencies and citizens dey lawfully empowered to use all necessary means to arrest and bring those wey dey try escape to justice.

Aregbesola give di warning sake of jail break for Kogi state wia over 200 prisoners escape.

“Elements wey dey seek to compromise di security of Nigeria no go fit challenge di Nigeria Correctional Service. We go deal wit di situation.

You should therefore know wetin you dey up against.

E go better make you wilfully surrender yourselves at di nearest law enforcement office,” Sola Fasure, tok-tok pesin for di Minister of Interior tok for statement.

Na 240 inmates dem forcefully release for di medium Security Custodial Centre (MSCC) for Kabba, officials tell BBC.

Di Controller-General of Nigeria Correctional Centre [Prisons] don order for full investigation

Haliru Nababa also order di immediate recapture of di prisoners wey escape.

Di incident happen for 2345hrs on 12th September, 2021.

Jail break in Kogi: How e happun

Tori be sey di heavily armed attackers wey plenty well-well invade di Custodial Centre and immediately engage di armed guards for serious gun battle.

O.F Enobore, tok-tok pesin for Kogi prisons for statement wey e bring out say “di Controller-General of Corrections, Haliru Nababa don order a recapture procedure to be activated immediately.”

Nababa also order for di commencement of detailed investigation as e personally lead a team to assess di situation.

Di DG appeal to the general public to provide useful intelligence wey fit assist to recapture di escapees to security operatives.

Goment establish Kabba MSCC for 2008 wit capacity of 200.

At di time of di invasion, na 294 inmates dey custody out of which 224 na pre-trial detainees and 70 convicted inmates.