Imo State news: Situation for Owerri as President Buhari visit Imo state

Nigeria President Muhammadu Buhari say im dey happy wit di projects im commission for Imo state.

Di president tok dis one afta e commission di Flood Control Tunnel di Flood Control Tunnel from Dick Tiger street to Otamiri river, Egbeada By-Pass and di Naze/ Nekede/Ihiagwa Road.

E say infrastructure go make pipo mind their own businesses, e add join say if road no dey, if security no dey, di pipo no go fit do anything.

E assure di pipo of Imo state say for di centre, im go try help di state within di constitution of di Federal Republic of Nigeria.

Nigeria President Muhammadu Buhari bin land Imo state, South East Nigeria earlier for a one day working visit.

Flood Control Tunnel from Dick Tiger street to Otamiri river, Egbeada By-Pass and di Naze/ Nekede/Ihiagwa Road.

BBC
Flood Control Tunnel from Dick Tiger street to Otamiri river, Egbeada By-Pass and di Naze/ Nekede/Ihiagwa Road.

Buhari land for Sam Mbakwe Airport for Owerri, di state capital, where dignitaries receive am.

Di Imo state govnor, Hope Uzodinma inside statement for im Facebook page say do President dey come di state to commission some projects.

“Na wit heart full of gratitude that I and on behalf of di good pipo of Imo state dey welcome His Excellency President Muhammadu Buhari come di Eastern Heartland on a working visit to commission some of our completed pipo oriented projects”. He write.

President Muhammadu Buhari go commission some major projects of Governor Hope Uzodimma, tok-tok pesin for di govnor tok.

Oguwike Nwachukwu, Chief Press Secretary to di Imo state govnor say di visit na to also show sey federal goment get interest for di development of di state.

According to Nwachuckwu projects wey President Buhari go commission na;

  • Balloon technology-driven underground tunnel with surface drainage – Chukwuka Nwoha
  • Naze/ Nekede/Ihiagwa Road
  • Egbeada By-Pass – Amakohia
  • Newly Built Exco Chambers – inside government house known as Douglas House.

Di President go also participate for a Town Hall Meeting wit South East Leaders.

Meanwhile, security operatives full ground for Owerri, Imo state as dem receive resident Muhammadu Buhari.

Di security operatives wey dey on patrol na part of di security measures di goment put in place to ensure say no kasala happun during di visit.

President in Imo

BBC

Markets for Owerri dey close as Buhari visit Imo

Meanwhile, di turn out for markets and other commercial activities dey low today for Owerri.

Shops wey dey one of Owerri biggest markets, Douglas markets dey locked but pipo wey dey sell food stuff gada in front of di market to sell dia goods.

Afta di president commission di projects, e go hold close door meeting wit stakeholders wey dey for di East plus all di state govnors for di region.

Shop for Douglas market

BBC
Market

BBC
Buhari in Imo

BBC

Pipo gada to welcome di President

Buhari in Imo

BBC
bUHARI IN iMO

BBC

We dey monitor events from di visit