Afghanistan news: Kabul airport attack ‘fit’ happun again soon – US President Biden reveal

US troops for Kabul airport

Reuters

Anoda attack fit happun for Kabul airport, US President Joe Biden don warn.

Oga Biden say im commanders don tell am say di attack fit happun as early as Sunday.

Di US State Department warn all US citizen make dem leave di area near di airport becos of one “specific, credible threat.”

US still still dey do evacuation but di last UK troops, diplomats and officials don leave Kabul.

Double suicide bombing bin happun on Thursday afternoon wey lead to di death of about 170 pipo.

One local branch of Islamic State group – Islamic State in Khorasan Province (IS-K) – claim di attack.

To revenge, US do drone strike for east of Afghanistan late on Friday wey dem cay kill “high-profile” IS-K members.

US describe di two members as one planner and one facilitator. E no clear weda dem directly get hand for di planning of di Kabul airport attack.

Italian evacuation flight from Kabul to Rome (28 August)

Reuters
Dis evacuees make am on di last flight to Italy

UK don finish evacuation

Downing Street, don confam say dem don evacuate di final group of dia troops, diplomats and official from Kabul.

Di kontri don evacuate more dan 15,000 pipo from Kabul since August 14.

Dis evacuation don end UK 20 years military intervention for Kabul for Afghanistan.

Prime Minister Boris Johnson say e go dey very difficult “for di friends and family of di 457 soldiers wey give dia lives” during di war.

Oga Johnson add say UK involvement for Afghanistan “keep al-Qaeda from our door for 20 years and all of us dey safer as a result.”