Paralympics: Why Nigeria dey perform better compared to Olympics – Solomon Dalung

Paralympics

Getty Images

‘Natural desire’ to achieve something for life na one of di reasons why Nigerian paralympians dey perform better’

Dis na in comparism to di normal athletes wey dey go Olympics, according to Nigeria Former Minister of Sports.

Solomon Dalung say anoda reason be say di disabled athletes dey less demanding.

Dalung tok for exclusive chat with BBC News Pidgin on Tuesday as di 2020 Paralympics kickoff for Tokyo Japan.

“One of di reason why Nigerian Paralympians dey always perform better be say physically challenged athletes by nature get strong will.

“And desire to achieve something for themselves, to make a name and do great things.”

“Anoda thing be say dis athletes no dey as demanding as di odas in terms wetin Nigeria give dem. Dem dey more content and just wan perform and do well.”

Di former Sports Minister wey serve between 2015-2019 also yan say;

Those in charge of disabled sports for Nigeria dey perform better for Paralympics because dem no dey selfish.

Paralympics medals table Tokyo 2020

BBC

For last Paralympics wey dem go for Rio 2016, di Nigerian team get 12 medals.

E consist of eight gold medals two silver and two bronze medals.

Dis include breaking world record by weightlifter Josephine Orji.

For London 2012 Paralympics wia Nigeria achieve six gold medals, five silver and two bronze medals.

On di other hand, Nigeria get 0 medals for 2012 Olympics, one bronze for 2016 Rio Olympics.

And one silver and bronze for 2020 Tokyo Olympics.