Olu of Warri Emiko coronation: Ogiame Atuwatse III reverse curse, declare key titles

Ogiame Atuwatse III

BBC

New Olu of Warri announce key declarations during im coronation as Ogiame Atuwatse III on Saturday.

Ogiame Atuwatse III, formerly known as Omoba Utieyinoritsetsola Emiko don wear crown as di 21st Olu of Warri.

Di new Olu of Warri wey also be King of Itsekiri nation for Delta State don officially change di title of im wife.

Di monarch declare her new title afta im coronation inside Warri, southern Nigeria.

Her title change from Princess Ivie Emiko to Olori Atuwatse III.

See oda important declaration di new Olu of Warri make:

Olu of Warri Emiko coronation: Ogiame Atuwatse III Tsola Emiko reverse curse, declare key titles

BBC
New Olu of Warri, Utieyinoritsetsola Emiko – Ogiame Atuwatse III

Ogiame Atuwase III reverse major curse

Ogiame Atuwase III reverse di curse wey Olu Erejuwa II plus Oba Akenzua II place on top im kingdom bifor bifor.

E release forgiveness and healing to di federal goment of Nigeria wey use dia power to carry out di offense.

“I decree peace, prosperity, progress ontop dis land.” na wetin im decree.

“We decree because Itsekiri dey blessed, Nigeria go dey blessed.” na wetin di new Olu of Warri add put.

Olu of Warri Emiko coronation: Ogiame Atuwatse III reverse curse, declare key titles

BBC
Olori Atuwatse III.

Ogiame Atuwase III give im mama new title

Di Olu of Warri honour two women for im life, im mama and im wife wit new titles.

Tori be say Ogiame Atuwase III na di first Olu of Warri wey im mama dey alive to see im coronation.

Di Queen mother also witness as im sitdon for di throne for di first in well ova two centuries .

Him officially change her name from Olori Atuwase II to Iyowu Atuwase II.

Olu of Warri Emiko coronation

Di Olu of Warri na first class traditional ruler and im dey rule ova all Itsekiri people both for Nigeria and abroad.

Royalties from across Nigeria attend di coronation ceremony wey happun for Warri, Delta State on Saturday.

Di Royal fathers include di Ooni of Ife and oda big-big men and women for di kontri attend di event.

All dis na afta weeks of preparation for Olu of Warri Emiko coronation.

You fit also like dis video:

Olu of Warri exclusive
The British Broadcasting Corporation

Biography of new Olu of Warri: Who be Ogiame Atuwatse III Tsola Emiko?

Dem born di then Prince Utieyinoritsetsola Emiko on 2nd April 1984 to Ogiame Atuwatse II, di Olu of Warri.

Little Omoba Emiko don enta dis world before im papa Ogiame (King) Ikenwoli Godfrey Emiko become king [Atuwatse II].

Im mama na Gladys Durorike Emiko, now Iyowu Atuwase II in Warri, Nigeria.

Prince Tsola Emiko get im basic education from NNPC Primary school for Warri wia dem born am.

Di new Olu of Warri do im secondary education for Adesoye College, Offa, Kwara from 1995 to 2001.

Im attend di Case Western Reserve University, Cleveland, Ohio, USA wia e collect im Bachelors of Arts degree.

Di royal major in International Studies & Political Science, while minoring in History & Economics from 2002 to 2006.

Di then prince [Omoba] marry Ivie Okunbo, daughter of billionaire Capt. Idahosa Okunbor for one ogbonge wedding ceremony for 2014.

Di marriage dey blessed with children.

Warri Kingdom short history

Di Kingdom of Warri [Warri Kingdom] or Iwere Kingdom (1480-1848) bin dey di colonial Nigerian traditional states.

Di Olu or Ogiame (King) of Warri now dey only rule di Itsekiri pipo wey dey in di town of Warri for Delta State of Nigeria as a traditional leader.

Ogiame mean “king of di river”.

Biography of new Olu of Warri: Who be Ogiame Atuwatse III Tsola Emiko?

BBC
Royalties from across Nigeria attend di coronation ceremony wey happun for Warri, Delta State on Saturday.

According to Bini and Itsekiri histories, Olu Ginuwa, a prince of Benin Kingdom na im discover di Warri kingdom about 1480.

For 1997, Nigeria Federal Government under General Sani Abacha create Warri South-West Local Government Council, with headquarters for Ogidigben wey be Itsekiri community in Warri.