Deputy Head of House BBNaija: Maria win HoH, pick Boma to assist plus new twist Big Brother introduce for di show

Biggie introduce new twist for di Big Brother Naija show on Monday night.

Biggie tell Maria to pretend say na she get di power to pick di two housemates wey go dey evicted on Sunday meanwhile di truth be say nomination and eviction no go hapun dis week but Maria go need to pretend say eviction go hapun and na her hand e dey.

Biggie wey call Maria to di diary room afat she pick her deputy bin tell her to keep am secret and convince di housemates say dia fate dey her hand if dem no impress her.

According to wetin Biggie tok. Maria go need to make di housemates believe say na she go determine di two housemates wey dey go home on Sunday and say she go choose dem based on di least housemates wey impress her during di week.

Big Brother meanwhile cut warning for her not to turn di housemates to ‘slaves’.

All dis one na afta Maria win di Head of House games and pick Boma as deputy.

Maria pick Boma as her deputy afta she become di newest Head of House for Big Brother Naija’Shine Ya Eye’ TV reality show.

She win di special position afta she defeat oda contestants wey bin also do di Head of House challenge.

Afta every body play, na she get di highest points with 28.

As Head of House, she bin suppose dey immune from eviction. But Maria no go get access to di HoH bedroom becos she break biggie rule and e ban her for two weeks. But her deputy wey she go later pick go get access if she no pick Liquorose or Peace wey Biggie also ban for two weeks.

Di game to determine dis week Head of House bin involve di usual game of dice just like as e dey for previous week.

But Biggie make am a bit easier for di housemates in dat e tell dem to start with any number instead of di number number six dice.

Pere as di outgoing HoH bin no play as e bin no dey qualified to play.

Peace, Boma and Pere be di housemates wey don win HOH before.