Community Shield: Leicester City 1-0 Manchester City – Kelechi Iheanacho penalty make im club win

Iheanacho

Getty Images

Substitute Kelechi Iheanacho confidently score late penalty as Leicester beat Manchester City to win di Community Shield for Wembley.

Di meeting of last season Premier League champions and FA Cup winners bin look like say e dey head for penalties, but Iheanacho strike from di spot into di top corner with one minute remaining afta Nathan Ake trip am.

Dem bin give City record £100m signing Jack Grealish im debut on 65 minutes, but e bin no fit get clear-cut opportunity.

Kasper Schmeichel bin tip over di cross bar Ilkay Gundogan free-kick and di German midfielder also bin no fit do much with one first-time effort im get from 10 yards out.

Also, Striker Jamie Vardy bi sharp for Leicester but bin no fit find way past City goalkeeper Zack Steffen, wey im ogbonge save bin deny di Englishman.

Jack Grealish

PA Media

Leicester supporters don experience five years of football wey be something wey for dey beyond dia wildest dreams – shock Premier League champions for 2016, surprise FA Cup winners last season and now dem dey waka enta di new season in an ogbonge way by winning di Community Shield.

Though dem play Champions League afta dia title win, dem don fall two times away from di top four in oda seasons even though dme bin look well set for much of di campaign.

But dem comot late for London to send Manchester City home disappointed as Nigerian frontman Iheanacho convert di winner against im old club 11 minutes after e come on.

City boss Pep Guardiola bin tok before kick-off about having little time to prepare for di new season and with “half of di team” wey dey out.

Di biggest of di casualties be Kevin de Bruyne and Phil Foden, wey suffer injuries during di European Championship, for summer and Raheem Sterling too wey also bin dey left out.