Usifo Ataga murder: Court remand Chidinma Ojwuku for Super TV CEO alleged murder

Chidinnma Ojukwu bin no fit plead or speak during her alleged murder trial first court hearing.

Yaba Magistrate High Court in Lagos bin sit for di first time to table di suspected murder of Michael Usifo Ataga wey be Lagos billionaire.

But Monday hearing na to remand di prime suspect and her co-defendant Quadri Adedapo, for thirty days in di first instance.

Chidinma Ojwuku lawyer no oppose di remand on top say e bin dey expect am.

Di goment lawyer alias prosecution say di reason for di remand na so dem go fit assign di case.

Police bin discover di Super TV CEO dead body inside one short let apartment for June 2021 for Lekki Lagos.

Na for June police arrest 21-year-old Chidinma wey be university student some days after dem begin search for one female suspect for di mata.

Di judge bin adjourn di Michael Usifo Ataga matter till September 5, 2021

Until then, Chidinma go dey prison yard for alleged murder accuse.