Jos Crisis: Wetin we know about di attacks for Plateau state

On Monday gunmen attack Riyom and Bassa communities for Plateau state wey dey northern Nigeria and eyewitnesses tell BBC say many pipo die for di attack.

According to eyewitnesses, no be only loss of life those communities suffer including dia houses wey di gunmen destroy, burn and also dia spoil dia plants for farm.

Some reports for Nigeria say na up to 43 corpses dem discover after di incident for one village wey dem dey call Irigwe.

Prince Robert Irigwe na chief for Irigwe village and e tell BBC say di reason why di attack worse for dia side na because security pipo no take action on time even after dem report to dem immediately.

Mr Dan Manjang wey be commissioner of information for Plateau state tell BBC say wetin happun dey unfortunate but security issue no be only for goment alone but na everybody business.

Auta Danjuma wey be anoda chief for Irigwe village say dem dey suspect herdsmen for di attacks but Miyetti Allah wey dey represent herdsmen for Nigeria deny di accusation.

Wetin Police tok

Tok tok pesin for Plateau State Police Command Gabriel Ubah say for di report wey reach dem for di attack na 4 pipo die and 50 houses destroyed.

For statement, di police add say immediately dem get report na im dem quickly send tactical team to restore peace.

E also add say commissioner of police don order fast investigation so dat dem go quickly fish out pipo wey carry out di attack.

Over di years Plateau don suffer plenti attacks wey lead to several loss of life and properties.

For one of di most memorable one wey happun for 2010 hundreds of pipo die and many properties destroy when clash break out on 17th January and spread to different towns for di state.