Simone Biles pull out of gymnastics women’s team final for Tokyo Olympics sake of mental health palava

Simon Biles

Getty Images

American ogbonge gymnast Simone Biles comot from di competition ground before her team go compete for di gymnastics women’s team final for Tokyo 2020.

Biles bin comot from di arena to enta treatment room even though she bin no get any physical injury.

She later reveal for interview say she comot sake of mental health issues.

Dis na afta she score her lowest score for her Olympic career on top vault wia she fail to land wella.

According BBC tori pesin, John Watson, she later comot di treatment room to support her team as she bin dey press her ankle.

Howeva, dem no gree her participate, and replace her with Jordan Chiles, and di USA team claim silver for di event.

Di 24 year old don reach all five of her individual finals and go compete next week Thursday.

If she win, she go become di first woman wey go retain all-around title since 1968.

Dis go be di second Olympics wey Simon Biles go compete.

Who be Simone Biles?

Biles na di most successful US gymnast for history.

She start her Olympic career for di Rio 2016 Olympics wia she gbab four gold medals and one bronze.

For 2019, she break di world record for di most decorated gymnast for di World Championship history as she win 25 medals overall for di competition.

Biles also don get two gymnast moves wey dem don name after her, di double-double dismount for a beam wey dem call “Biles”.

And the move wey she go be di first woman to complete, di triple double move for floor, wey dem call “Biles II”.