Big Brother Naija 2021 housemates: Africa Magic reveal BBNaija Shine Ya Eye housemates

Di 2021 edition of di biggest reality TV show for Nigeria, Big Brother Nigeria don officially start.

According to di show host Ebuka Obi-Uchendu di show go last for 10 weeks.

Dis year, di title of di show na ‘Shine Ya Eye’ and for di first night, na only di boys dem reveal.

Dem go reveal di girls for di Sunday part of di show.

Dis season get two launch shows. Di first launch happun on Saturday 24 July, di second go be on Sunday 25 July. Di launch show go start by 7pm West African time.

BBNaija na di biggest reality show for Africa, ova 49 kontries for di continent tune in to watch di season launch wey start by 7pm West African time, according to di show organizers.

Who be di housemates?

Boma

Im be 34-years-old mixologist wey also don do some modelling and be former footballer.

Raised by im single mother and grandmother, Boma bin don marry before.

Boma suffer injury during football try-outs, im dey determined to “never, ever, give up” and hold onto im faith.

Okusaga

Dis 28-years-old engineer come from Lagos State. Okusaga aka Saga say im go “bring vibe to di house”.

Im say di lowest point for e life na wen im hear say e mama – wey im describe as e best friend – don die.

Yousef

Dis bi-racial Nigerian be teacher come from Jos, Plateau State and plan to bring lots of entertainment for di show.

Im sey e go like make pipo dey call am Yousef.

Pere

Drama and gbas-gbos, na one of di housemates wey Ebuka announce as housemate on di show.

Pere say im be actor and plan to “bring spontaneity to di audience on di show”.

Whitemoney

Im say e be businessman wey dey into import of shoes.

Multitalented Whitemoney describe imself as open-minded “jolly good fellow” wey like to catch fun.

Di 29-year-old Lagos based Whitemoney originally come from Enugu State.

Niyi

Dis former basketballer come from Oyo State and e don marry wit one pikin.

Im also be businessman wey dey run fantasy game platform and event business for Cape Town, South Africa.

Niyi dey 6’6” in heigth and likely go be di tallest housemate on dis season edition of di show.

Yerins

Im be medical doctor wey say “e like to eat even though e no dey show for im body”.

E describe imsef as ‘polymath’ wey get undying love for many creative things.

Jay Paul

29-years-old Jay Paul come from Calabar, Cross River state, e describe imsef as “social butterfly”.

Im be complete entertainer wey dey run tourism business. Jay Paul dey act, sing and dance as well.

Emmanuel

Im be 24-year-old model wey come from Akwa Ibom State.

Emanuel na model wey dey into pageantry and be winner of Mr Africa.

E dey single and say possibility dey say im go fit “mingle”.

Sammie

Sammie na final-year student wey dey study Guidance & Counselling for Ahmadu Bello University, Zaria.

Im come from Kaduna State and plan to enjoy imsef for di show.

Cross

31-years old Ikechukwu love clubbing, dancing and girls wey also like to see “women fight over am”.

E dey into yoga and plan to bring drama “Wey concern boys and girls fight”.

See BBNaija past winners

Big Brother Nigeria 1 Katung Aduwak$100,000

Big Brother Naija 2 Efe Ejeba N25,000,000

Big Brother Naija 3 Miracle Igbokwe N45,000,000

Big Brother Naija 4 Mercy Eke N60,000,000

Big Brother Naija 5 Olamilekan Agbeleshe N85,000,000