Eid-el-Kabir: President Buhari Salah message to Nigerians

President Muhammadu Buhari don advice Nigerians to get patience as e goment go solve di palava of hardship wey dey worry di kontri.

Di president tok dis one for di Eid message to Nigerians as dem dey prepare to celebrate Eid el-Adha wit dia Muslim brethren for different parts of di world.

“Let me also use dis opportunity to reassure Nigerians say we dey take measures to address our security challenges.

“We don start to dey take delivery of fighter aircraft and oda necessary military equipment and hardware to improve di capacity of our security forces to confront terrorism and banditry,” president Buhari tok

E say im goment dey ready to create kontri wia justice, harmony and prosperity go dey and where life and properties go dey safe.

Wetin be Eid Kabir?

Muslim faithful celebrate di end of di Ramadan fasting

Getty Images
Muslim faithful celebrate di end of di Ramadan fasting

Eid el Kabir wey some pipo dey call ‘big or ram sallah’ na one of di two Eids muslims dey celebrate.

E dey happun on 10th day of Dhul Hijja wey be last month for Islamic calendar.

One of di significance of Eid Kabir for Muslims na say dem go get reward for every hair wey dey di body of animal wey dem slaughter.

For pipo wey dey do Hajj na one of di important things as dem go slaughter ram and give out to charity.

Na time wey family visitations dey very important and get plenti reward according to Muslim beliefs.

Oda Things wey President Buhari tok for im Sallah Message

President Buhari also tok about di different challenges wey di kontri dey currently face including Covid-19 pandemic, flood, agriculture and security.

E say Covid-19 pandemic don really affect di economy of many kontris including Nigeria.

Di president say dem dey work hard to bring relief to Nigerians including to make fertilizer dey available for affordable prices to farmers.

“No goment don invest di kain moni wey dem don invest to promote local production of about twenty commodities through providing of loans and oda kains of support to farmers,” di president add.

President Buhari end im message by encouraging all Muslims to continue to live “in peace and harmony” wit dia fellow kontri men and make Nigerians expose di bad eggs wey dey cause security palava for di kontri.

Eid-el-Kabir festival wey dem cancel

Kano Emirate Council don cancel dis year Durbar celebration.

One media aide to President Muhammadu Buhari, Bashir Ahmed wey give di informate say di council cancel am sake of di third wave of Covid- 19 also obey gometn directive.

Durbar festival na big Muslim celebration dem dey do afta Eid every year for most northern cities across Nigeria.

Di festival dey start wit prayers plus colourful parade of di Emir and im followers on top horse. Na occasion to merry, relax and enjoy.