South Africa looting: Jacob Zuma di president for whom unrest in South Africa dey happun

South Africa looting: Jacob Zuma di president for whom unrest in South Africa dey happun

Getty Images

Looting, riots and unrest dey shake South Africa no because Jacob Zuma latest prison sentence.

Zuma don achieve political embarrassment as di first former president of di rainbow nation wey dem go send to prison.

Zuma life as a free man – wey bin enjoy di enjoyment of a former president – ended just before midnight on 8 July, 2021.

Dan na di date wen for one dramatic scene dem escort Zuma for convoy of vehicles from him domot for Nkandla village to one prison.

Jacob Zuma prison dey inside di town of Estcourt.

Constitutional Court on June 29 slap Zuma wit 15 months prison sentence for refusing to appear before one corruption investigation.

Authorities bin dey investigate corruption accuse during di nine years wen Zuma hold power as South African president.

Im son, Edward Zuma, bin warn South Africa say dem go see “blood on di floor” if im chop arrest, but in di end e happun.

Now at least 72 pipo don die for di riot wey dey happun for South Africa.

Zuma supporters enter streets to protest, mount road block to demand di release of di former President.

A mother in Durban is forced to throw her baby from a building after it was set on fire
The British Broadcasting Corporation

South African former president Jacob Zuma: Profile

Jacob Gedleyihlekisa Zuma na South African politician wey serve as di fourth President of South Africa from 2009 to 2018.

Zuma bin once be a celebrated political figure.

Im bin go prison for 10 years in 1963 for fighting di racist system of apartheid in South Africa.

Zuma den go into exile in 1975 to become di spymaster of African National Congress [ANC].

Thereafter e return to South Africa in grand stlye in 1990 and rise to be president in 2009.

Though by then im reputation don dey stained by many corruption allegations.

Humble roots and house in South Africa

Jacob Zuma don also face charge of raping a family friend, but dem free am in 2006 inside a trial wey deeply divide di ANC.

ANC na di former liberation movement wey become become di governing party in 1994 which Zuma don be member since di age of 17.

Now, e done enta prison for contempt of court wey involve South Africa most senior judges.

Dis judges na di guardians of di democracy e fight for most of im life.

South Africa looting: Jacob Zuma di president for whom unrest in South Africa dey happun

Getty Images
Jacob Zuma signature song use to be di liberation anthem Bring Me My Machine Gun

Earlier dis month, di judges of the Constitutional Court sentence am to 15 months in prison for especially im relationship with di Gupta brothers.

Di Gupta brothers bin japa from South Africa for 2018 as di legal noose close in on them.

Dem all don deny di allegations, and Zuma insist say im political enemies dey use di courts to target him.

Wetin Jacob Zuma do for South Africa

Na man wey fight against racial oppression in South Africa at di height of di Cold War between US and now-defunct Soviet Union.

Based on dis, Zuma still see imsef as di victim of a political conspiracy wey Western powers cook.

And im feels say dia boys in South Africa na im di western powers dey use scata attempts to end di economic power of white pipo for di kontri.

For im critics, di former freedom fighter wey from a poor rural family became intoxicated by power once dem win di liberation struggle.

And along with im new business friends critics claim say Zuma loot di goment wealth on a grand scale.

South Africa looting: Jacob Zuma di president for whom unrest in South Africa dey happun

AFP
See di controversial home of South African President Jacob Zuma in Nkandla on January 21, 2014

Where di truth remain still dey yet to be established.

But na tribute to South Africa 27-year-democracy say a former freedom fighter and president dey imprisoned for trying to avoid accountability.

E show say South Africa democratic institutions – wey politicians dey always scata – remain strong.

And judges, policemen and government officials still dey prepared to uphold di rule of law by jailing a man wey some of dem personally know.

Zuma na pesin wey those wey jail am bin dey wit for dia liberation struggle.

Most high-profile prisoner

South Africa looting: Jacob Zuma di president for whom unrest in South Africa dey happun

Getty Images
Jacob Zuma dey face multiple corruption charges

Zuma more than 15 counts include racketeering, corruption, fraud, tax evasion and money laundering .

All dis charges na wetin im don plead not guilty during a court appearance in May.

With Zuma fighting legal battles on various fronts, di big question na: Him go ultimately win and walk free, or im go gain even more fame as South Africa’s most high-profile prisoner?


Jacob Zuma: Im legal palava:

  • 2005: Charged with raping family friend – acquitted in 2006
  • 2005: Charged with corruption over multi-billion dollar 1999 arms deal – charges dropped shortly before he become president in 2009
  • 2016: Court order say make dem no charge am wit 18 counts of corruption over di deal – he appeal, but in 2017 lost one attempt to overturn dem
  • 2016: Court rule say im breach im oath of office by using government money to upgrade private home in Nkandla – E don repay di money
  • 2017: Public protector say make e appoint judge-led inquiry into allegations say Zuma make profit from im relationship di wealthy Gupta family – e deny allegations, just as di Guptas
  • 2018: Zuma approve inquiry into claims of state looting
  • 2018: Di National Prosecuting Authority confam say Mr Zuma go face prosecution for 12 charges of fraud, one of racketeering, two of corruption, and one of money laundering, relating to di arms deal, wey im stil dey deny.
  • 2021: Begin a 15-month jail sentence afta di Constitutional Court order im arrest for refusing to testify for one commission into state looting