Sound Sultan died: Olanrewaju Abdul-Ganiu Fasasi death, life and times 1976-2021

Sound Sultan don dey buried for Muslim cemetery, New Jersey, USA.

Di singer wey real name be Olanrewaju Ganiu Fasasi die at di age of 44.

Plenti pipo regard di Jagbajantis singer [Sound Sultan] as one of di pipo wey start modern hip hop music for Nigeria.

Wetin kill Sound Sultan?

Di Nigerian talented singer die of throat cancer on Sunday 11 July, 2021, according to im family.

Sound Sultan bin sick of Angioimmunoblastic T-cell lymphoma, di family statement from Dr. Kayode Fasasi tok.

Recently for May 2021 tori bin come out say di singer bin sick before im sudden death.

“Sound Sultan dey survived by im wife, three children and im siblings.” Dr. Fasasi add.

Celebrate me by Sound Sultan

Di song wey Sound Sultan one week ago before e die na about celebrating pipo while dem dey alive.

For di post, e describe anoda musician Pantoranking songs as World Best.

https://www.instagram.com/p/CQ3pmGLgEhK/?utm_medium=copy_link

Like everi successful artist, Sound Sultan don tell Nigerians about im self including im birth, education, career and more.

Everi bodi know am Sound Sultan but im real name na Olanrewaju Abdul-Ganiu Fasasi from Oyo state.

But dem born am for Jos, Plateau state.

Sound Sultan na rapper, singer-songwriter, actor, comedian and recording artist.

Sound Sultan songs

Most of im songs address social issues.

Make we quickly first look at some of im very popular songs for Nigeria.

Sound Sultan start im music showbiz career for early ’90s wen e begin host shows to raise money for studio sessions.

Mathematics – Sound Sultan

For year 2000, e released im breakthrough hit song ‘Mathematics’ — di song wey im use BODMAS to advocate a new approach to governance in Africa.

Jagbajantis – Sound Sultan

Dis na im be im first song, e release for di year 2000. Dat tiime dis song na anthem dat year.

Ole – Sound Sultan

Sound Sultan release dis track in 2011 from di album, Bush Meat.

Natural something – Sound Sultan

Na for 2013 dis particular song land.

Kokose – Sound Sultan ft Wizkid

Dem release dis one in 2013 from di album Me, My Mouth & Eye

Motherland – Sound Sultan

E drop Motherland in 2016 from di Album, Out Of The Box.

Orobo – Sound Sultan

Sound Sultan use dis particular track promote body positivity among plus-sized women.e drop for 2013 featuring Excel, from di album 51 Lex.

Sound Sultan showbiz life and times

By 1999, e don win multiple talent shows.

Afta e release BODMAS and oda singles, di musician join Kennis Music.

Under Kennis Music, Sound Sultan release four studio albums.

When im contract with di label expire in 2007, him and im elder brother Dare ‘Baba Dee’ Fasasi, to start Naija Ninjas.

Naija Ninjas later serve as di parent company to a record label, production outfit, and clothing line.

Sound Sultan do different music genres; from R&B to afrobeats, soul, and fuji music.

Under Naija Ninjas, e he released several albums and signed artistes like Karma Da Rapper, Young GreyC, Shawn, and Blacka.

Di rapper start to workg with Wyclef Jean, di Haitian-American rapper, aft a e show alongside 2face Idibia and Faze on ‘Proud to be African’ ,

Dat na one song for Wyclef’s ‘Welcome to Haiti: Creole 101’ album.

In 2012, Sound Sultan become UN ambassador for peace sake of im lifestyle.

Sound Sultan 1976-2021 – Biography

Dem born Sound sultan for November 27, 1976 and im na di fourth out of six children.

Im father na Liadi Alarape Fasasi and im mama na Adeyinka Ajarat Fasasi.

Sound sultan dey married wit three children – one girl and two boys.

Sound Sultan educational background

Sound sultan attend Stepping stone nursery and primary school between 1981 and 1987.

Im later move go federal goment college Ogbomosho from 1988 to 1993 for im secondary school education.

Sound Sultan get BSc for Geography and regional planning from Lagos state university for 1999.

Musical career

Plenti pipo regard Sound sultan as one of di pipo wey start modern hip hop music for Nigeria.

Sound sultan career for show biz start as early as in di 1990s – wia im begin do show to get money to pay for im own studio session.

Im start to get interest for music from 1991 as im begin mime for school before im begin write im own lyrics.

Sound sultan begin learn how to play guitar after im secondary school education and by 1999 im don get im own band.

He attributes his early influence to his elder brother baba dee, who studied theatre arts.

Also for 1999 Sound sultan don win plenty local talent hunt shows and by 2000 im release im first single ‘Jagbajantis’ wey make am blow.

Na later as Sound Sultan become popular before Nigerians know say Baba Dee, another music star n aim brother.

Sound sultan don work under two major record labels; Kennis Music from 1997 to 2008 and Naija Ninjas from 2008 till now.