Miami building collapse: Four die, 159 pipo dey miss – officials

Firefighters search for survivors under collapsed Miami building
The British Broadcasting Corporation

Di number of pipo wey officials torchlight say still dey miss inside di collapse of one 12-storey building for di US city of Miami don side to 159.

Four people don die.

Di mayor of Miami-Dade say dem “still get hope” say dem go find survivors. Rescue pipo wey dey work non-stop dey hear pipo under di building dey bang walls to show say dem still dey alive.

Dem don already rescue plenti pipo.

Wetin cause di 40-year-old building to collapse on Thursday morning no dey clear.

Building collapse in surfside Florida updates:

AFP
Di building get mostly holiday homes so e no clear who dey

Already dem don learn say 102 bin suppose dey di building as occupants.

But dem no sure how many bin dey inside wen e collapse.

Authorities also dey try to find wetin cause di building to collapse.

How dem dey try rescue pipo from di building?

Miami map

BBC

President Joe Biden don approve emergency declaration for Florida.

Dis one mean say, di Federal Emergency Management Agency go fit join di rescue efforts.

Miami-Dade Police Director Freddy Ramirez tell tori pipo say:

Fire and rescue bin carry dia search team plus including dogs enta to find pipo wey still dey.

But dem tok say dem dey take am slow and steady to make sure say di remaining building no crash ontop those wey neva die.

Constant rain and storms for di area don also make di work to hard pass how e be.

Authorities don already dey take DNA from families to match.

Di move na in case na di deadibodi of di victims dem find for dia.