Wales vs Denmark: Christian Eriksen Danish side beat Welsh team 4-0 to reach Euro 2020 quarter finals

Dolberg celebrates goal

Getty Images

Denmark win Wales 4-0 to be di first team to qualify for di quarter finals from di round of 16.

Wales drop out of di second round of Euro 2020 afta Denmark flog dem to continue with dia inspiring journey for di tournament to di quarter-finals.

One brilliant strike for di 27th minute from Kasper Dolberg wey e cut inside afta e collect di ball from Mikkel Damsgaard put Christian Eriksen team ahead.

Dolberg strike again for di 48th minute as e caitalize on one defensive error from Wales substitute Neco Williams to smash in from close range.

Dat goal kill Wales morale, dem no show sign of coming back into di game as Joakim Maehle add one late third goal for di Danish side.

Substitute Harry Wilson collect straight red card for a late foul on Maehle before Martin Braithwaite strike a fourth goal in added time to rub salt for Wales injury and end dia campaign on a sad note.

Robert Page men bin perform well to get out of difficult Group A wey also feature Italy, Switzerland and Turkey, but di ogbonge Danish side prove say dem dey anoda level.

Denmark na already team wey some dey root for, especially sake of their touching story to reach dis stage, afta midfielder Christian Eriksen recovery from cardiac arrest bin ginger dem.

Di first game of di Last 16, knockout stage for di Euro 2020, wey happun for Amsterdam bin Kick-off around 17:00 BST.

Wales bin finish as Group A runners-up while Denmark come second from Group B

While sabi pipo say Danish player Christian Eriksen wey collapse during Denmark first match of di tournament with Finland continue to provide inspiration for di Denmark side for di tournament.

Wales prove pre-tournament predictions wrong to reach dis stage and with Gareth Bale and Aaron Ramsey dem bin believe say dem get a real chance of bringing back dia dream Euro 2016 campaign.

Di next stop for Denmark ogbonge tori go be Baku for a last-eight tie with the Netherlands or the Czech Republic next Saturday.

As for Wales, dem go return home tired but proud of their efforts to reach di knockout stages again for di third time for a major tournament.

Some match facts

Denmark bin don win six of dia previous 10 meetings, with Wales wey win four.

Di Danes defeat Wales two times for di 2018 Nations League, where Christian Eriksen score both goals in a 2-0 win for Aarhus.

Denmark be winners for Euro 92, dem finish fourth for 1964 and reach di semi-finals for 1984 but dis na dia first appearance for di Euros knockout stages since 2004. Dem lost 3-0 to di Czech Republic for di quarter-final.

Mikkel Damsgaard (20 years 353 days) become Denmark youngest goalscorer for a major tournament for di win versus Russia. E get three goals and three assists for im past five caps.

Pierre-Emile Hojbjerg get three assists for three games for Euro 2020. One more go set a new national record for assists inside a single major tournament.