2021 Jamb “UTME Result” portal: Jamb released results summary, how to check 2021 result

Joint Admissions and Matriculation Board [JAMB] don release di 2021 Unified Tertiary Matriculation Examination [UTME] results.

JAMB Head of Media announce di release for statement issued on Friday morning.

Fabian Benjamin say: “Dem seize alias withheld some few results for further investigation.”

Benjamin statement add say di results for subsequent days go dey released daily.

Jamb however direct candidates wey sit for di UTME to check dia results by sending:

“UTME Result” to 55019 through di GSM number each candidate use obtain profile code and UTME registration wit di Board and dia results go reach dem sharperly.

BBC
UTME na exams wey di Joint Admissions Matriculation Board [JAMB] dey conduct.

Di statement read in parts:

“Di Joint Admissions and Matriculation Board [JAMB] don release results of candidates wey sit for more than 720 CBT centres.

Dis results na “for di 2021 Unified Tertiary Matriculation Examination dem conduct between Saturday, 19th and Tuesday, 22nd June 2021.

“Each concerned candidate dey advised to check his/her result by sending UTMERESULT to 55019 through di GSM number dem use register wit di board.

“And dia results go reach dem. Result for di coming days go dey released daily.

“Di Board note with satisfaction say di use of NIN [National Identification Number] don help reduce examination copy copy alias malpractices.

Dis na as di 2021 UTME don record di least ojoro since dem start to do CBT examinations inside Nigeria. Jamb statement add.

“Nevertheless, di Board go still review all di CCTV footages and oda technical gadgets to find possible examination misconducts.

“In addition, di Board no go waste time to withdraw di results of any candidate wey dem later find to don commit any form of examination misconduct.” Jamb tok.

Meanwhile, dis na di steps candidates fit use check and print dia original result slip.

How to check 2021 UTME JAMB result online

  • Go di JAMB result checking portal for https://portal.jamb.gov.ng/eFacility_/CheckUTMEResults.
  • Enter your JAMB Registration Number/Email Address for di required column.
  • Click on ‘Check My Results’.
  • Di portal go load your result if e don ready.

How to check JAMB result via SMS

  • Candidates go send RESULT, via SMS, to 55019 wit di same number you use register for JAMB.
  • If one candidate use phone number wey dem no use register, message go come say im no use di number register for di exam.
  • Candidate wit result go receive message: “Dear Mr/Miss X, your result na as follows… (and dem go provide di details).
  • If Jamb don withhold your result, e go still send message to tell di candidate “Result Withheld”

If you also need print out your result slip, dis na di easy steps to follow.

Although, according to JAMB website, candidates gatz pay N1000 to print dia results.

How to Print Original JAMB Result Slip

Login to your JAMB profile through https://www.jamb.gov.ng/EfacilityLogin

Under di list of post Registration e-Facilites (for di left side of di page) – Click on di “Print Result Slip”

You go click on “continue wit payment” to make payment through di Remita platform.

After your payment don dey successful, you fit proceed to print your result slip.

Just ‘select your exam year’ and enteryour ‘JAMB Registration Number’ for di required columns.

Candidates go need to submit di original result slip during admission screening for any tertiary institution of dia choice.

Wetin Jamb dey tok about candidates wey miss di UTME 2021 exam or get any wahala?

Report any complaints to e-ticket for di JAMB Portal

Many of di administrators wey dey conduct di exams dey give assistance to help.

Candidates wey get any complaints like late coming sake of di curfew fit resolve am.

Dem gatz to go to di e-ticket section for di Jamb portal go make formal complaint.

Jamb create e-ticket portal wey each candidate fit go lodge dia individual complaints.

And dem go monitor and effectively treat di complaint.

For di portal, dem go click Ticket/support for di menu bar.

Then go click create support Ticket to lay dia complaint or click Access Existing Ticket.

Dem fit also send sms to 55019 to make same complaints.

JAMB Acting Director, Shittu Billiaminu say dem go also organize mop up examination.

Dis mop up go cover candidates wey get oda pending issues.

Dis na concerns wey dem neva resolve wey make dem no fit write di examination.