BBNaija Lockdown Reunion 2021: Highlights from TolaniBaj/Vee ‘smack’ clash for ‘BBNaija reunion’

Fans of Big Brother Naija reunion shock afta dem watch Tolanibaj and Vee clash during Monday reality show.

TBaj clash wit Vee afta Prince claim say wen dem bin dey try sort dia relationship issues she (Tolani) bin dey cut eye for Vee boyfriend Neo.

But Tolanibaj explain di reason why e happun.

Di Lagos based tori reporter turned celeb say:

“I bin wan use Neo to make you jealous and show you how man suppose be, becos definitely you no be man.”

Dis na di first time wey di lockdown gang dey come togeda for di same place since di show end for September.

Di reunion na to clear di air and tok dia church mind towards each oda.

Wetin Vee tok about Tbaj thing wit Neo?

According to Vee she say she no know say anything like dat bin dey happun.

And she no believe say Tbaj go do dat kain tin.

“E pain me, why you go do dat kain tin, Tolani your friends go dey watch you for TV and dem go dey shocked”

“Why you go tok say you no dey desperate and you tok say if Neo come out and still dey interested in you, you go dey okay wit dat.”

Na dia wey Tbaj change am for Vee, come stone her pillow and warn her not to tok to her like dat.

Wetin Tolani Baj tell Vee?

Tolanibaj address her friendship wit Vee, she say di reason why she stop to be Vee friend na because Vee na bitter leaf.

Vee para for wetin Tolani tok and she no waste time to respond back.

“I be bitter leaf, I be witch, and I accept it” Vee tok

As Vee dey try to answer Ebuka question again ontop di mata, Tbaj tell her say:

“I go smack you silly” as her fellow housemates dey try calm down she add say “e fit be for hotel sha oh”.

How fans react?

Afta di episode finish fans begin chook mouth about di ladies clash

One fan kendis_gold say “I dey shame for T baj.”

Anoda fan official_babyjay2424 write say:

“Everyone dey fight because of one man, so e mean none of dem bin dey relationship before dem go for di show”

While Urhiofe say “UK and US dey fight for Warri”

And for cathsdiary e say “These ones wey no tok pim for di house dey show power for reunion”

More days still day for di reality show to reveal more.

Tolanibaj, Vee, Brighto O, Kiddwaya, Lucy, Neo, Dorathy, Prince, Praise, Nengi, Trikky Tee, Wathoni and Ka3na all attend Monday episode.