Tokyo Olympics: Ugandan don test positive for Covid for Japan

Woman with dog in front of Olympic rings. File photo

Getty Images

One member of Uganda Olympic squad don become di first to test positive for Covid-19 on arrival for Japan for di competition due to start on 23 July.

Di event bin dey postponed last year, but now go go ahead despite fresh wave of Covid-19 cases for Japan.

Uganda dey also experience surge in cases, wey force di government to tighten lockdown measures on Friday.

Di Ugandan wey bin dey part of nine-member squad bin don dey fully vaccinated, according to reports.

Di group – wey include boxers, coaches, and officials – bin also test negative before dem leave Uganda.

However, one of dem test positive wen dem arrive Tokyo Narita airport on Saturday, and bin dey quarantined for one government-designated facility, na so local media bin quote say Japanese officials tok.

Di rest of di squad travel by chartered bus to Osaka, for western Japan, wia dem go train ahead of di Games.

A protester holds a placard during a protest against the Tokyo Olympics on May 17, 2021 in Tokyo, Japan

Getty Images
Officials have refused to call off the Games, saying it will be safe and secure

Di Ugandans na di second group of foreign athletes wey go arrive for training ahead of di competition. Australia women softball squad arrive on 1 June.

Foreigners wey wan travel come watch di Olympics dey banned. On Monday dem go take decision on whether to allow domestic spectators.

High public concern over Games

Wit no spectators for di Games na di “least risky” option, Japanese medical experts don tok.

But other Japanese officials don indicate say dem want domestic fans to attend if e dey possible.

Tokyo report 376 cases of Covid and one death on 20 June, 72 more than one week ago, di privately owned The Asahi Shimbun newspaper report.

Polls for local media suggest say public concern about di Games taking place still dey high amid slow vaccine roll-out.