Heart starting device: Christian Eriksen go get ‘ICD – implantable cardioverter defibrillator’ implant afta cardiac arrest

Getty Images
Christian Eriksen bin require emergency treatment ontop di footbal pitch before dem cari am go to hospital

Danish footballer Christian Eriksen go get implant of heart-starting device afta im collapse for pitch during Euro 2020.

Di 29-year-old Denmark midfielder suffer cardiac arrest for match wey Finland win im team inside Copenhagen on Saturday.

Implantable cardioverter-defibrillator – ICD dey “necessary due to rhythm disturbances”, Danish team doctor Morten Boesen tok.

Eriksen still dey for hospital but say im dey “fine under di circumstances”.

Heart starting device meaning

Di British Heart Foundation describe ICD as a small device wey dem dey put under di skin.

E dey connected to di heart with “thin wires” and e dey “send electrical pulses to regulate abnormal heart rhythms”.

Heart starter also dey known as implantable cardioverter defibrillator [ICD].

Experts dey place di device under di skin just below di collar bone, to di heart and monitor your heart rate through electrodes.

BBC
ICD graphic

Boesen add say: “Christian don accept di solution and even sef di plan don dey confirmed by specialists nationally and internationally wey all recommend di same treatment.

“We encourage everybodi to give Christian and im family peace and privacy.”

Former Spurs player Eriksen, wey dey now play for Inter Milan, collapse shortly before half-time against Finland and im go need to be revived with a defibrillator.

German doctor Jens Kleinfeld, wey bin treat am ontop di field, tell Funke media group: “About 30 seconds later, he open im eyes and I fit tok to him directly.

“Dat na a very moving moment, because inside such medical emergencies for everyday life, di chances of success dey much lower.”

Kleinefeld say im ask Eriksen, “Well, you don come back wit us?”

Di doctor say Eriksen bin ansa, “Yes, I don come back wit you” and, “Kai, I be only 29 years old”.

Kleinefeld add say: “Dat na wen I know say di brain no dey damaged and he don fully return.”

Denmark next game na against Belgium on Thursday [17:00 BST] wen dem go return to Parken Stadium, wia Eriksen collapse.

Belgium plan to kick di ball out of play for di 10th minute to take part inside one minute applause for Eriksen, plus Danish fans wey dey plan wey dey plan to clap hands as a show of support.

Denmark players bin surround Eriksen as im receive treatment ontop di pitch before dem take am go to hospital.

Di match resume and dem play to a conclusion two hours afta di incident, with Finland going on to win 1-0.