Hungary vs Portugal: Ronaldo become European championship highest goal scorer as di reigning champions win dia first game

Cristiano Ronaldo

Reuters

Cristiano Ronaldo don became di top scorer for men European Championship history as Portugal beat Hungary in front of more than 60,000 fans for Budapest.

Ronaldo score for di 87th-minute with penalty for im 10th goal for di competition, to overtake F Michel Platini from France wey dey on nine goals.

Im 11th goal come only a few minutes later wen he take di ball pass goalkeeper Peter Gulacsi for Portugal third.

Hungary bin defend well for di match and e bin look like say di game go end for draw until dem concede three times late on for di match.

But na for 84th minute game change wen Raphael Guerreiro bin fire shot wey scata Hungary defense and comot defender Will Orban for road.

Di oda Group F teams na World Cup Champions France and former champions Germany and dem go play for Munich later on Tuesday.

Di game bin no easy for Portugal to win as dem play in fromt of di biggest crowd for di tournament so far.

For di 67,000 capacity Puskas Arena for Budapest.

Afta dis, Hungary go stay Budapest to play against France on Saturday. And den Portugal go play France for Munich.