Is there public holiday on “June 12”?: Nigeria FG declare ‘Monday 14th June 2021 public holiday’

BBC
Late Chief MKO Abiola na di face of June 12 Democracy Day

Federal Goment don declare Monday 14th June 2021 a public holiday across Nigeria.

Di public holiday na to mark dis year Democracy Day celebration wey be on Saturday 12 June.

Nigeria Minister of Interior, Ogbeni Rauf Aregbesola make dis declaration on behalf of di Federal Goment.

E follow advice all citizens to support di present administration for dia effort to secure United and prosperous Nation.

Dis time around June 12 fall on a weekend, so goment choose di first working day afta di observance as public holiday.

On June 12, Nigeria Police boss say make police officers across di kontri remain firm wit any group wey wish to take advantage of di event to threaten di internal security order.

IGP Alkali Baba marching land ahead of di “June 12” protest some pipo and groups dey plan to hold on dat day.

Is there public holiday on June 12? 'Is Monday 14th June 2021 a public holiday?'

SEYLLOU
Nigeria President Muhammadu Buhari

Why June 12 be Democracy Day in Nigeria

Nigeria President Muhammadu Buhari on June 6, 2018 announce say June 12 na di new day di kontri go dey celebrate Democracy.

“For di eye of Nigerians, sometin wey goment also believe, 12 June 1993, dey more special for Democracy for Nigeria pass May 29, or even October 1.”

Na wetin Buhari tok wen e change date for Nigerians to observe Democracy day from May 29 to June 12.

Originally na on dis day na im dem cancel di 1993 Nigeria general election wey dem believe say MKO Abiola win.

Buhari also cari award give di late Chief Moshood Kashimawo Olawale [MKO] Abiola as di Grand Commander of di Federal Republic.

Buhari goment also award Ambassador Baba Gana Kingibe, wey be Abiola running mate, Grand Commander of di Niger (GCON).

Chief Gani Fawehinmi also collect GCON award, sake of say im be human rights fighter wey drag wit authorities to make June 12 possible afta dem bin don cancel di election for 1993.

So since afta dat declaration in 2018 di west African kontri dey get holdiday to mark dia Democracy Day.