Mali ‘coup’: Interim President Bah Ndaw and Prime Minister Moctar Ouane don ‘resign’

President Ban Ndaw

Reuters

Mali interim President Bah Ndaw and Prime Minister Moctar Ouane don resign afta military detain dem for two days for di barracks of Kati near di capital, Bamako.

According to sources, di military force dem to resign as dem read and sign statements wey dem don write down hours before international communities’ observers land di kontri.

During one high level meeting wit di troika delegation wey dey composed of Ecowas, AU and UN representatives, di two leaders announce their resignation.

Di West African mediators wey Nigeria former president Goodluck Jonathan dey di kontri wit hope say dem go arrange their release from military detention.

On Tuesday, di new president of di transition Colonel Assimi Goita explain why military arrest di interim president and di prime minister.

He accuse dem say dem sabotage di transition clauses for statement plus dem no involve am for di cabinet wey dem reshuffle wey see to di reappointment of prime minister Moctar Ouane.

Two main members of di ex junta no get positions for di new government. According to analysts, dis fuel di anger of di military wey their presence for all di strategical ministries don dey challenged for month for di kontri.

Assimi Goita now na di only pesin wey dey lead di kontri as di positions of Vice President and prime minister dey vacant.

Dis go be di second coup in nine months.

United Nations don call for calm for di kontri.

Timeline of Events

Soldiers for Mali detain di President Bah Ndaw and Prime Minister Moctar Ouane of di interim government on Monday.

According to di United Nations and di African Union, dis arrest go cause more political chaos for di sub-Saharan African kontri just nine months afta one military coup bin comot di former leader of di kontri.

Late on Monday, PM Ouane tell tori pipo for AFP for one phone call say, soldiers “bin come carry am”. Di news agency say dj line later cut.

Di reported detention dey come just hours afta one government reshuffle, wey replace two senior army officers wey take part for last year coup.

Once again, Mali dey look unstable just nine months after di military coup wey comot President Ibrahim Boubakar Keïta from office.

Many Malians bin welcome oga Keita departure – but dem dey vex as military dominate di transitional goment and di slow pace of promised reforms for di kontri.

One previous coup wey happun for 2012 also lead to militant Islamists exploiting di instability to seize territory for northern Mali.

French troops bin help to regain territory, but attacks continue.