Coronavirus: Police arrest Nigerian actress Funke Akindele say she ‘party’ for lock-down

Police for Lagos Nigeria, say dem don arrest Nigerian actress Funke Akindele say she break restriction order.

Di Lagos State Police Command torchlight one viral video wey show plenty pipo from di entertainment industry inside one Estate, along Aja, Ibeju-Lekki axis, Lagos dey celebrate birthday party wey Funke Akindele Bello and her husband organize.Police detectives from di State CID yaba sharpaly go di location. “We bin arrest Funke Akindele. Investigation still kontinu, and we dey work to arrest di remaining pipo inside di video, like Azeez Fashola aka Naira Marley and Abdul Rasheed Bello aka JJC Skills. ” Statement from di police tok.

E go pay dis pipo to report do di State CID yaba by demsef on Monday 6th April, 2020 or dem fit see say we don declare dem wanted. Di statement add.

Dis wan dey come afta di actress, release video ontop social media to apologise to her fans afta di video of her husband birthday party show for social media.

She say she “sorry” say she mislead pipo with di party video despite say Lagos goment don advise social distancing for di state as dem dey try to stop di spread of coronavirus.

She tok say she dey support goment with all di rules wey dem put for ground to make sure say dem stop di spread of COVID-19 for di state.

Meanwhile, Nigerians bin enta social media to para say di actress no follow lockdown rules.

Nigeria don record ova 200 cases of coronavirus and di state wia di party bin hold, Lagos State, na di most affected state for di kontri with ova 100 cases of coronavirus.

Lagos state announce lockdown for two weeks as goment dey try stop di spread of di virus, dem even ban parties and gatherings of over 20 pipo and dem dey advise social distancing rule for di state.

Afta di video of di birthday party surface for social media, Nigerians show dia disappointment say celebrities suppose dey lead by example.

Some pipo say make di Nigeria Centre For Disease Control quarantine her and everybody wey come di party.

And some of her fans say no be only am dey guilty to throw party.

For tweet wey she bin delete, di actress bin first explain say all di pipo wey come di party don dey together for ova two weeks.

But plenti pipo for social media no tink say her excuse dey enough to put her family and oda pipo in harms way at dis critical time wey di kontri dey try contain di spread of di virus.

So far, out of di 224 cases of coronavirus wey Nigeria don record 5 pipo don die and 27 pipo don recover.