Ondo Yoruba nation rally: Wetin Governor Rotimi Akeredolu say about di Ilana Omo Oduduwa Akure protest

Ondo state Governor, Rotimi Akeredolu, say e no support those pipo wey dey call for Yoruba Nation.

Akeredolu say di fact say im respect di right of individuals and groups to hold peaceful rallies, make pipo no misunderstand to mean support for secessionist agenda.

Govnor Akeredolu tok dey come afta one pro-Yoruba nation group wey dey ginger for di ethnic group to break away from Nigeria carry protest enta di streets of Akure on Saturday, 22, May, 2021.

Di agitators be members of di pro-Yoruba nation group, Ilana Omo Oodua.

Di governor react for one statement titled ‘Yoruba Nation Agitators On Their Own ‘ wey im Chief Press Secretary, Richard Olatunde bring out.

“Governor Akeredolu wish to state clearly say while e acknowledges di right of individuals and groups to hold peaceful rallies, make pipo no misunderstand dat to mean support for secessionist agenda and or diving of di nation. E dey far from dat.”

Akeredolu say e neither believe, nor support di quest for di Yoruba Nation outside of Nigeria for di manner wey dem dey campaign.

E add say im stand by a ‘virile, united and indivisible Nigeria’ according to di demand by di Southern Governors Forum.

Di Governor explain say e dey important to state say di Yoruba Nation secessionist promoters no dey get any support from am.

Yoruba Nation Rallies and who dey ginger am

Yoruba nation rally

BBC

No be only Ondo state di rally for Yoruba Nation (Ilana Omo Oodua rally) don take place.

On 15 May, hundreds of pipo wey dey clamour for Yoruba nation gada to do peaceful rally for Osun state, south west of Nigeria.

For April, police disrupt Yoruba Nation rally wey dem bin wan do for Ibadan, Oyo State capital.

Yoruba rights activist, Chief Sunday Adeyemo, popularly known as Sunday Igboho wey dey lead dis rallies say no going back on di demand for a Yoruba nation.

Di Yoruba nation ginger begin loud more recently sake of di palava of di herders-farmers mata wey dey also affect di region.