How dem rescue Nigerian girl guardians cage for eight months

Nigeria authorities don rescue a girl wey her own guardians cage and starve for eight months.

Police rescue di 12-year-old girl inside Sokoto State northwest Nigeria.

E happun for Cinema area for Sokoto North Local Government Area.

Dem rescue di victim on Thursday, May 13, PRO of Sokoto police ASP Sanusi Abubakar tok.

Di police tok-tok pesin add say dem arrest di guardians wey cage her for dia home.

Tori be say dem lock up di girl and no give her food because of her health condition.

Confaming wetin happun to tori pipo ASP Abubakar say:

“Dem keep di girl in a cage for dia compound and starve her of food for eight months.

“When our men brake di door of di cage, di girl bin dey too weak to walk because she don emaciate.

“We meet her in a very horrible situation, she dey pee and poo inside di cage.”

Dem don take di girl go one specialist’s hospital for treatment. Di police PRO add.

Police say dem go later hand over di girl and di suspects dem arrest for further action.

Dem plan to give dem to di National Agency for the Prohibition of Trafficking in Person and other Related Matters.